8
Den God tell Moses, “Go tell Fero sey, ‘Dis na wetin God tok, “Make yu let my pipol go serve mi! But if yu nor gri release dem, den I go make frog kover una land and una go sofa. Frog go full River Nile and dem go still dey inside una house, bedroom, on-top una bed, inside una savants and una pipol house; una pots and di kontaina wey una take dey fetch wota. Di frog go trobol yu, yor pipol and all yor savants for dis land.” ’ ”
God tell Moses, “Go tell Aaron, ‘Take di stik wey dey yor hand take face di river, creek and di ponds and frog go full evriwhere for Egypt.’ ” So as Aaron stresh di stik on-top di wota wey dey Egypt, frog kom full evriwhere for di land. Di juju-men sef kon use dia juju pawa take bring frog join di ones wey dey di land.
Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”
So Moses tell Fero, “I go dey happy to pray for yu, yor savants and yor pipol, so dat di frog go komot from yor land go back to di river. So na wish time yu wont make I pray.”
10 Fero ansa, “Na tumoro.”
Den Moses sey, “E go bi as yu tok, so dat yu go know sey nobody bi like di Oga wey bi awa God. 11 Di frog go komot from yu, all yor savants and yor pipol house and na only di frog dem for inside River Nile, go remain.”
12 Moses and Aaron kon waka leave Fero. Den Moses pray to God make E remove di frog wey E send kon meet Fero. 13 God do as Moses wont and all di frog inside dia house, village and farms, kon die. 14 Egypt pipol gada di frog and dem nor fit kount am, den evriwhere kon dey smell for di land. 15 But wen Fero si sey di wahala don end, en heart kon strong more and e nor gri listin to dem, just as Oga God tok.
Third Wahala: Plenty San-san Fly
16 God kon tell Moses, “Make yu tell Aaron sey, ‘Nak di san with di stik wey dey yor hand and plenty san-san fly go kom out for evriwhere for Egypt.’ ” 17 So Aaron nak di san with en stik and san-san fly kon full evriwhere for Egypt. 18 Wen di juju-men try to bring out san-san fly with dia juju pawa, dem nor fit do am. So san-san fly kon dey gada both Egypt pipol and dia animals.
19 Di juju-men kon tell Fero, “Dis na God handwork!” But Fero heart still strong and sturbon and e nor gri listin to dem, just as God tok.
Fourt Wahala: Plenty Fly
20 God tell Moses, “Make yu wake-up for early morning go meet Fero as e dey go di river kon tell am, ‘God sey, “Make yu let my pipol go serve mi! 21 If yu nor gri let dem go, I go send plenty fly kom meet yu, yor savants, yor pipol and for inside una house. All Egypt pipol house and di groun go full with fly. 22 And for dat day, I nor go let di fly dem rish Goshen land where my pipol dey, so dat yu go know sey na mi, di Oga God dey do dis tins. 23 I go divide my pipol from yor pipol. Dis sign go happen tumoro.” ’ ”
24 God do as E tok and fly wey dem nor fit kount kon full Fero, en savants and Egypt pipol house and many tins spoil, bikos of di fly dem.
25 Den Fero koll Moses and Aaron kon sey, “Make una go sakrifice to una God inside di land.”
26 But Moses sey, “Dat nor bi wetin wi suppose do, di kind sakrifice wey wi won do for di Oga awa God na wetin Egypt pipol dey forbid. If wi make sakrifice wey Egypt pipol dey forbid for dia face, dem nor go stone us die? 27 So wi must travel for three days go inside di wildaness go sakrifice to di Oga awa God, just as E don dey tell us since.”
28 Fero kon sey, “I go let una go sakrifice give di Oga una God inside di wildaness, but una nor go-go too far. Make una pray for mi too.”
29 Moses ansa, “I go leave yu go pray to God and tumoro, all di fly go komot from Fero, en savants and en pipol, so-far yu nor go deceive us again or nor let us go sakrifice to awa God.”
30 So Moses komot from where Fero dey kon go pray 31 and Oga God do as Moses ask. E remove all di fly from Fero, en savants and en pipol. 32 But Fero heart still dey strong and sturbon as before and e nor gri free di pipol.