9
Fift Wahala: Sickness
Den Oga God tell Moses, “Go meet and tell Fero sey, ‘God wey bi Hibru pipol God sey, “Make yu let my pipol go serve mi! Bikos if yu nor gri let dem go and yu kontinue to hold dem, I go use my pawa bring sickness kom meet una animals for fields, una horse, donkey, kamel, kattle, sheep and goat dem. But I go separate Israel animals from Egypt pipol own. No Israel animal go die.” ’
“Mi wey bi Oga God don sey na tumoro I go do dis tin wey I tok.” True-true God do dis tin for di next day. All di animals for Egypt pipol farm die, but no one for Israel pipol own, die. Fero kon send pipol go find out and true-true, Israel pipol animal nor die. With all dis tins wey dey happen so, Fero heart still strong and e nor gri free di pipol.
Sixt Wahala: Boil For Body
Den Oga God tell Moses and Aaron sey, “Make una gada ashes from where dem for dey burn firewood, den make Moses blow dem for air for di king front. Di ashes go skata like dust for Egypt and e go kause boil wey go turn to sore for Egypt pipol and dia animals body.”
10 So dem gada di ashes from di firewood kon stand for Fero front. Den Moses blow di ashes for air and e kon turn to boil for both Egypt pipol and dia animals body. 11 Di juju-men nor fit stand for where Moses dey, bikos of di boil wey full dia body and Egypt pipol own. 12 But God still make Fero heart strong and e nor gri listin to dem, just as Oga God sey e go bi.
Sevent Wahala: Ice-blok Rain
13 God kon tell Moses, “Make yu get up for early morning go meet Fero kon tell am, ‘God wey bi Hibru pipol God sey, “Make yu let my pipol go woship mi! 14 Bikos dis time, I nor go only ponish yor savant and pipol, but I go ponish yu too, so dat yu go know sey nobody bi like mi for di whole world. 15 If to sey I take sickness attack yu and yor pipol, all of una for don die finish. 16 Dis na di rizin why I neva kill yu. I just won show yu my pawa, so dat pipol go praiz my name for evriwhere for di eart. 17 Yu still dey karry body up and yu nor gri free my pipol. 18 So, by dis time tumoro, I go make strong ice-blok rain wey dem dey koll ‘hail’, fall as e neva fall for Egypt before. 19 So naw, make yu go tell yor pipol make dem gada all dia animal and evritin wey dem get komot from di field kon kover dem for house. Dis na bikos anybody wey di ice-blok rain fall meet for outside, go die!” ’ ”
20 Doz wey bi Fero savants wey dey fear God word kon rush go gada dia savant and animals enter house. 21 But di rest ones wey nor bilive Oga God word kon leave dia savant and kattles for outside.
22 Den God tell Moses, “Stresh yor hand go heaven make di ice-blok rain fall for Egypt; on-top di pipol, animals and evritin wey dey grow for Egypt.”
23 Wen Moses stresh di stik wey dey en hand go heaven, God kon send tonda and plenty ice-blok and fire kon dey fall for groun: so Oga God make ice-blok fall like rain for Egypt. 24 Fire wey mix with ice-blok kon dey fall too. Di rain strong well-well and Egypt pipol neva ever si dis kind rain before. 25 Di ice-blok distroy evritin wey dey di field, both pipol and animals. Di rain distroy evritin wey dey grow for di field kon break di trees to pieces. 26 But di ice-blok rain nor fall for Goshen land where Israel pipol dey stay.
27 So Fero send for Moses and Aaron kon tell dem, “Dis time I gri sey I don sin! God dey holy and na mi and my pipol dey guilty. 28 So make una help mi beg God, bikos di strong tonda and ice-blok too mush and I go free una and una nor go stay here again.”
29 Moses ansa am, “Wen I komot go inside town I go stresh my two hand go heaven to di Oga wey bi God, den di tonda go stop and di ice-blok nor go fall again, so dat yu go know sey na Oga God get di whole world. 30 But I know sey yu and yor savants neva still dey fear God.”
31 (For dis time, di plant wey dem dey koll flax and barley don skata and die, bikos di barley don ripe and di flax dem just dey won get flower. 32 But e nor get any wheat wey distroy, bikos dem neva grow kom out.)
33 So Moses waka leave Fero kon go inside di town stresh en two hand go heaven as e dey pray and di tonda, di ice-blok and di rain kon stop to fall. 34 Wen Fero si sey di rain, ice-blok and di tonda don stop, e kon still sin again: both en and en savants kon get strong heart. 35 So Fero heart still dey strong and e nor gri release Israel pipol, just as God tok.