2
I go stand for where I for dey guide and look well-well.
I go wait make I for know wetin God go tell mi
and how E go take ansa my komplain.
God Ansa
So God ansa:
“Di vishon wey I dey tell yu naw,
make yu rite am down make e klear,
so dat anybody wey read am,
go undastand am well-well.
Make yu rite am even doh e neva rish time for di vishon to happen.
But di time go soon rish and wetin I show yu,
go happen.
E fit bi like sey e nor go happen,
but make yu wait; e go must happen
and e nor go tey again.
Si proud pipol,
all wetin dem dey do nor dey good for my eye.
But doz wey dey do good, go get long life,
bikos dem dey obey my laws.
True-true, wine go disgrace proud and wiked pipol!
Dia mout wide like grave and just as deat nor dey beleful,
na so too nor-tin dey beleful dem.
Bikos of dia long-trot,
dem don gada nashons kon swallow many pipol.
“But very soon, di pipol wey dem katch, go ponish who katch dem. Dem go sey,
“ ‘Una take wetin nor bi una own and naw,
una own don finish!
But na how long dis kind tin go kontinue?’
Den pipol wey una dey whole money,
go kom kollect dia money.
Dem go turn face una kon take evritin wey una get.
Una don tif from many nashons,
so doz wey still dey alive, go tif from una.
Una don kill pipol
kon kause wahala for di whole world.
So e betta make una die, dan to dey build big-big house with money wey una tif.
Una do like dis, so dat una go fit run from wahala and trobol.
10 Una don disgrace unasef
and una life don finish,
bikos of di pipol wey una kill
and as una take distroy many nashons,
na so too dem go distroy una.
11 Even di stones for wall and ceiling dey kry
and komplain against una.
12 Una wey build town with money wey una play wayo
and kill pipol take get, na curse go follow una.
13 But make una dey sure about dis!
Oga God wey dey kommand heaven sojas don tok:
Evritin wey di nashons dey do nor mean anytin;
all dia work go dey yuzles.
14 Just as wota full sea,
na so too dem go know about God glory
for evriwhere for dis world.
15 Una wey dey make una neighbours drink too mush,
so dat dem go naked and disgrace demsef,
na big curse dey una head.
16 Instead make dem honor una, na disgrace go follow una
and na una by unasef go drink kon stagga fall.
God go make una drink from una own ponishment cup
and una honor go turn to disgrace.
17 Just as una distroy Lebanon,
na so too dem go distroy una finish.
Una kill all di animals wey dey der,
but naw, animals go worry and kill una.
Dis tin go happen, bikos of di pipol wey una kill
and di wahala wey una kause for dis world.
18 Na wetin juju dey good for?
Nor bi sometin wey pesin make with en hand?
Na wish good e do wey go make who make am,
trust am?
Na god wey nor fit tok!
19 Curse dey una head!
Una dey tell ordinary wood and stone sey,
‘Make una wake-up kon save us!’
Juju go fit tell una anytin?
Dem fit make am with silva and gold,
but e nor get life at-all.
20 But Oga God dey en holy temple,
so make evribody for di world,
keep kwayet for en present.”