3
Habakkuk Prayer
Dis na di prayer wey Profet Habakkuk pray:
My God, I don hear evritin wey Yu do
and e sopraiz mi well-well.
Even naw for awa time,
make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before.
Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.
God dey kom from Teman;
God wey dey holy dey kom from Mount Paran.
En glory kover di heavens
and na en praiz full di eart.
E dey shine like sun as E dey kom
and lite dey shine from en hand,
where en pawa der.
E send diziz go for en front
kon kommand deat follow am for back.
Wen E stop, di eart go start to shake
and wen E look, di nashons go bigin fear.
All di mountins go skata;
di hills wey dey since go sink
and E go dey forever and ever.
I si Kushan pipol dey fear
and as Midian pipol dey waka dem kon dey fall.
My God, na di sea make Yu dey vex?
Yu really dey vex for di river dem?
No! Yu dey kom with yor shariot kon save us!
Yu dey ready to use yor bow kon shot yor arrow.
Yor lite for heaven dey divide di eart into two.
10 Mountins dey fear as dem si Yu;
rain dey fall from di kloud
and waves for sea dey raiz
and make nois bikos of Yu.
11 As dem si yor arrow dey kom with speed
and as yor spear dey shine,
di sun and di moon nor fit move
komot from where dem dey.
12 Yu vex mash pass di eart
and as Yu dey vex,
Yu kon skata all di nashons.
13 Yu go save yor pipol
and di king wey Yu choose.
Na Yu kill di pesin wey dey lead wiked pipol
kon distroy doz wey dey follow am.
14 Wen en sojas gada dey kom like strong breeze
to kom skata and opress us,
Yu kill dem with yor arrow.
15 Yu mash di sea with yor horse
and di mighty river kon dey foam.
16 I fear well-well wen I hear all dis tins
and my lips kon dey shake.
Fear and kold katch mi at wons.
I go really wait for di time wen God go ponish
doz wey dey attack us.
17 Even doh di fig and olive tree nor get fruit naw
and di grape nor gri grow for di vine
or sey di land produce korn
and all di animals don die,
18 I go still dey happy and sing for joy,
bikos na Oga God dey guide mi.
19 God wey get pawa dey give mi strent.
E make mi stand strong for groun
like deer kon keep mi save on-top di mountin.
(For di kwayamasta:
Make dem sing dis song with instrument like, jita.)