5
Judgement
“Una wey bi priest,
make una listin!
Israel pipol,
make una listin well-well!
Una wey kom from royal family,
make una listin well-well too
bikos I dey kom judge una.
Una lead di pipol enter trap
bikos all of una dey woship juju
for Mizpa and for Mount Tabor.
Una don dig one deep pit for where una dey woship juju,
so I go ponish all of una.
I know Israel pipol well-well;
di wiked tins wey dem do,
nor go fit hide from mi.
Dem don turn ashawo
kon make demsef dirty.
Warnin
“Dia wikedness nor allow dem
turn kom meet mi wey bi dia God,
bikos di juju wey dem dey serve,
dey shark dem and dem nor won know mi at-all.
Israel pipol sturbones dey tok against dem.
Dia sin dey make dem kick stone fall
and Judah pipol dey fall with dem too.
Even wen dem kom sakrifice animals give God
make E for favor dem,
dem nor si am bikos E don turn from dem.
Dem nor dey faithful to God
and dem born shidren wey nor know dia papa.
So naw, di new moon festival go distroy dem
and dia land.
War Between Judah And Israel Pipol
“Make una blow di war trumpet for Gibeah!
Make una blow di wiso for Rama!
Make una blow di trumpet for Bet-Aven!
Benjamin pipol make una shake with fear!
Bikos Judgement Day dey kom
wen dem go distroy Israel pipol.
Wetin I dey tok naw,
go really happen to una!
10 “God sey,
“Judah leaders bi like pipol wey dey kut pipol land take.
So I go pour my vexnashon like heavy rain for dia body.
11 Dem go opress and judge Israel pipol anyhow,
bikos dem don make up dia mind to serve juju.
12 I go distroy Israel
kon turn Judah land to where dem dey trowey dirty put.
13 Wen Israel si as e dey sick
and Judah si as e sore big rish,
dem kon go meet Assyria great king
make e kom help dem,
but e nor fit cure or heal dia wound.
14 I go attack Israel and Judah pipol like lion.
Mi mysef go tear dem to pieces
kon karry dem komot der
and nobody go fit save dem.
15 I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin,
den dem go dey look for mi.
Yes! Dem go really look for mi
bikos dem dey sofa.”