6
Israel Still Dey Sin
Make una kom make wi turn go meet God!
Na-im wound us, but E go heal us!
Even doh E wound us, E go bandage awa sore.
Afta two or three days, E go heal us,
so dat wi go fit stay for en present again.
So make wi serve God.
As far day dey break and rain dey fall for di eart,
E go kom save us.
But God tell dem,
“Israel and Judah pipol,
wetin I won take una do?
Bikos di love wey una get for mi
dey kwik disappear like dew for morning;
like dew wey dey vanish wen day dey break.
Na dis make mi send my profet
kom give una di judgement and distroshon message.
Just as day dey break for morning,
na so too, my judgement go kom meet una.
Nor bi animals sakrifice I wont,
but na una love wey nor dey die.
E betta make my pipol know mi,
dan all di burnt ofrin wey dem dey give mi.
But just like Adam, my pipol sef break di kovenant
wey I make with dem.
Na wiked pipol full Jabesh-Gilead town
and na pipol blood kover all dia street.
Di priests dem bi like tif wey hide for bush
bikos one attack pesin.
Dem dey kill pipol for di road
wey dem dey pass go Shekem
and dem still dey do many wiked tins!
10 I don si wiked tins for Israel:
Judah pipol don make demsef dirty,
bikos dem dey woship juju.
11 As for una Judah pipol,
I don set time wen I go take ponish una
bikos of una sins,
even doh sey I go make my pipol prosper again.”