10
Una own don finish!
Una wey dey make wiked laws and dey opress my pipol.
Una dey opress poor pipol
and nor gri give dem dia freedom.
Una dey do like dis, so dat una go fit tif from shidren wey
nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die.
Naw, wetin una go do wen God won judge una?
Wen God bring wahala from far kountry kom meet una,
na who una won run go meet make e help una?
Where una go hide una propaty and money put?
Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas
or to sleep with doz wey dem don kill.
And with all dis, God still dey vex
and E dey ready to kill dem with en own hand.
Assyria
God sey, “I dey use Assyria pipol
as weapon to take ponish pipol wey I dey vex for.
I send Assyria pipol go attack di nashons wey nor know mi kon karry,
tif and skata di pipol like dirty for street.
But Assyria king get en own wiked plan for mind,
wey bi to distroy many nashons.
E even dey boast sey,
‘All my kommanders go bi king!
I don win Kalno, Karkemish, Hamat and Arpad towns.
Yes, I still win Samaria and Damaskus pipol.
10 Even kingdoms wey dia juju strong and fine pass Jerusalem and Samaria own,
I still distroy dem.
11 So just as I don do to Samaria and all en juju,
na so too I go do to Jerusalem
and all di juju wey dem dey woship.’ ”
12 But God sey, “Wen I finish wetin I dey do for Mount Zion and Jerusalem,
I go ponish Assyria king, bikos e dey proud and e too boast.”
13 Assyria king sey, “Na mi win all dis nashons by mysef.
I strong well-well, wise and get sense.
I skata nashons boundary kon karry all dia propaty.
Na with my strong hand and pawa I take
distroy strong rulers and kings.
14 All di nashons bi like bird house for my hand
and I gada dia propaty just as dem dey gada egg.
Yes! No feada fit make mi fear
and no bird fit open en mout sey e won bite mi!”
15 But God sey, “Axe go fit sey e big pass di man wey dey use am?
Abi cutlass dey important pass pesin wey dey use am kut sometin?
Nor bi gun dey karry pesin wey hold am,
but na di pesin dey karry am.”
16 Bikos of dis, Oga God wey get pawa go ponish en pipol with sickness.
Yes! En glory go-go up like smoke.
17 Den God, wey bi Israel lite, go bi like fire.
God wey dey holy go bi fire and E go use one day
take burn Assyria king and en pipol.
18 Just as pesin wey dey sick dey die dey go,
na so too God go distroy Assyria forest and en beauti
19 and na only some tree wey shidren go fit kount,
go remain.
Some Pipol Go Kom Back
20 But time dey kom wen Israel pipol wey go survive
nor go depend on di pipol wey almost distroy dem.
Instead dem go only depend
and trust Israel God wey dey holy.
21 Some of dem go kom back!
Yes Jakob shidren wey remain
go kom back to dia God wey get pawa.
22 But as Israel pipol plenty like san-san for wotaside,
na only few go kom back,
bikos na di distroshon wey fit dem,
dey wait for dem.
23 Yes! Oga God wey get pawa go bring distroshon
kom di whole kountry,
bikos E don tok am.
God Go Ponish Assyria
24 Oga God wey get pawa tell en pipol for Zion,
“Make una nor fear Assyria pipol;
even doh dem dey opress una as Egypt pipol bin do una.
25 E remain small for mi to ponish una finish,
den I go distroy dem for una.
26 Mi, God wey get pawa, go use my kane take flog dem,
just as I flog Midian pipol for Oreb Rock.
I go ponish Assyria pipol,
just as I take ponish Egypt pipol before.
27 Wen dat time rish, I go free una from Assyria pipol pawa
and dem nor go bi load for una shoulder again.
I go free una, bikos dia load go too dey heavy for una to karry.”
Enemies Attack
28 Enemies don katch Ai town!
Dem leave dia tins for Mikmash kon pass thru Migron,
29 den dem cross kon go sleep
for Gibeah dat nite!
Pipol for Rama town dey fear
and di pipol wey dey for Saul village for Gibeah,
don run komot der.
30 Gallim pipol! Make una shaut well-well!
Laishah pipol! Make una listin naw.
Anatot pipol! Make una ansa!
31 Madmenah and Gebim pipol dey run go hide,
so dat dem nor go die.
32 Enemies dey Nob town today
and dem dey ready for war for Mount Zion wey dey Jerusalem.
33 But awa Oga God wey get pawa go kut
and skata dem for groun like tree branches.
Di ones wey dey proud and dey karry body up,
God go ponish dem well-well.
34 God go kut dem with axe,
just as dem dey kut big trees for forest
and dem go fall for groun like Lebanon fine tree!