9
Di Future King
True-true, even wen God dey judge, E still promise to diliver us and wi nor go sofa again. Before-before, dem disgrace Zebulun and Naftali pipol, but naw, God don bring honor kom di place where di sea pass; di side afta Jordan River go rish where Galilee pipol dey.
Pipol wey dey waka for darkness don si lite.
Lite dey shine for doz wey dey stay for di land
where strong darkness dey.
Yu don make di pipol plenty
kon give dem great joy.
Dem dey happy for yor present,
just as doz wey dey harvest wetin dem plant
dey happy
or as sojas dey celebrate
wen dem divide wetin dem karry kom from war.
All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load
and di kane wey dem take dey flog dem.
Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol,
just as Yu bin defeat Midian sojas.
True-true, dem go burn di boot wey di sojas take fight
and dia klot wey blood stain.
Bikos dem don born one pikin for us!
God don give us boy pikin!
E go bi awa ruler and dem go koll am,
“Wonderful Advise, Mighty God,
Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”
En royal pawa go kontinue to grow.
En kingdom go get peace forever.
E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa;
e nor go opress pipol
and E go rule from naw go rish wen di world go end.
God Almighty go do all dis tins.
God Go Ponish Israel Pipol
God don sey, “I go judge Israel pipol
wey bi Jakob shidren-shidren.”
Israel and Samaria pipol wey get pride
and sturbones go know kon sey,
10 “Di bricks house don fall,
but wi go build am with stone again.
Dem don kut di sikamore tree,
but wi go replace am with cedar wood wey fine well-well.”
11 So God kon make dia enemies attack dem.
E make dia enemy vex attack dem.
12 Siria pipol kom from di east side,
while Filistia pipol kom from di west
kon surround Israel pipol make dem for kill dem.
And with all dis, God still dey vex
and E dey ready to kill dem with en own hand.
13 Even with all dis ponishment from God,
Israel pipol nor gri turn from sin
go meet di Pesin wey go save dem.
Dem nor even tink to setol with di Oga God
wey dey lead heaven sojas.
14 So, na one day God go take ponish Israel leaders and en pipol.
E go kut dia head and tail komot.
15 Na di old pipol and rulers, bi di head,
while di tail, na di profet wey dey lie waka.
16 Di leaders don konfuse dis pipol
kon lead dem enter distroshon.
17 So God nor go let any of di yong men eskape;
pity for doz wey dia husband don die
or doz wey nor get papa and mama again.
Bikos all of dem dey wiked;
dem nor know God and evritin wey dem dey tok, bad well-well.
But God vexnashon nor go end
and E still dey ready to ponish en pipol.
18 Di pipol wikedness dey burn like fire
wey dey distroy both grass and shuku-shuku.
E dey burn forest
and en smoke dey go up to heaven.
19 Bikos God wey get pawa dey vex,
en ponishment dey burn di land like fire
and E dey distroy di pipol
and dem nor dey sorry for each oda.
20 Dem attack dia neighbour from rite, but dem still dey hongry.
Dem chop dia neighbour from left, but dem nor beleful.
Dem even dey chop dia own shidren join.
21 Manasseh pipol dey fight Efraim pipol,
den dem join togeda go fight Judah pipol.
And with all dis, God still dey vex
and E dey ready to kill dem with en own hand.