13
God Go Ponish Babilon
Dis na di message wey God give Isaya wey bi Amos pikin about Babilon.
Make yu go on-top di hill go raiz di war flag!
Make yu shaut and wave yor hand,
so dat di sojas go fit enter di prince gate.
I don give orda to di sojas wey I choose,
I go take revensh thru di sojas wey I give pawa to fight
and dem go show as I dey vex rish.
Di mountin dey make nois like wen many sojas dey mash!
Strong wahala dey among di kingdoms and nashons dey gada togeda!
Oga God wey dey lead heaven sojas,
dey gada dem togeda to go fight.
Dem kom from far-far kountry;
from evriwhere for di world.
Yes! God dey vex kom skata di whole kountry.
So make una kry with pain,
bikos di day wen God go judge una don near;
di day wen God wey get pawa won take distroy evritin.
So bikos of dis, evry hand go weak
and evribody heart go fail am.
Fear go katch all of dem with pain like woman wey won born.
Dem go dey look each oda with fear and shame go full dia face.
Si, di day wey God go judge us dey kom;
na dat day E won take show en vexnashon,
den di eart go turn to desert
and E go distroy evribody wey dey sin.
10 True-true, all di stars and oda tins wey dey shine,
go stop to shine.
Di sun go dark as soon as e won kom out
and di moon nor go give any lite again.
11 God sey, “I go bring wahala kom di eart
and I go ponish all di wiked pipol, bikos of dia sin.
I go make anybody wey dey proud, honbol
and I go ponish evribody wey dey sturbon and wiked.
12 Just as pure gold nor plenty,
na so too di pipol wey go survive, nor go plenty.
13 For di day wey mi,
God wey get pawa go show my vexnashon,
I go shake di heavens and di eart go shake
komot from where e dey.
14 Di strenjas for Babilon go run go dia own land
and dem go skata like animals
wey dey eskape from hunta or like sheep wey
nor get who dey look dem.
15 Anybody wey dem katch,
dem go shuk am die and anybody wey dem seize,
na swod go kill-am.
16 Dem go kill dia own shidren for dia front;
dem go tif evritin for dia house
and oda pipol go rape dia wifes for dia present.”
17 God sey, “I go make Medes pipol attack Babilon pipol.
Dem nor dey kare about silva and nobody fit tempt dem with gold.
18 Dem go use dia bows and arrows kill di yong men and dem
nor go pity for small shidren or new born baby.
19 Na Babilon pipol fine pass for all di kingdom
and na dis make dem dey proud.
But mi God, go distroy Babilon,
just as I take distroy Sodom and Gomorrah!
20 Nobody go stay der again.
No human being go ever stay der again
and nobody wey get animals
go karry en animal go chop grass for der again.
21 Na wild animals go dey stay der
and na birds go full dia house wey go don skata.
Ostrich go dey stay der
and na for der wiked goats go for dey play.
22 Hyenas and jackals go dey make nois for di towa and di palis,
bikos Babilon time don nearly finish!
En days don dey pass!”