14
Israel Pipol Kom Back From Babilon
Oga God go pity en pipol, Israel.
E go choose dem as en own kon let dem stay di land again
and strenjas go kon stay der with dem.
Oda pipol go help Israel pipol kom back to dia land.
Israel pipol go kom back to di land wey God give dem
and pipol go serve dem.
Den Israel pipol go opress doz wey bin katch dem
kon rule di pipol wey bin sofa dem.
Babilon King
Wen God don free Israel pipol from dia pain, sofa and di hard work wey dem force dem to do, dem go laf Babilon king kon sey,
“Make una si as evritin take end
for di king wey dey opress pipol!
E nor go ever fit opress anybody again!
God don break wiked pipol pawa
and di hand wey dem take dey rule.
Dem vex skata and kill pipol for oda kountries
and dem nor dey taya.
Dem vex rule oda kountries as dem like
kon dey opress di pipol and e nor taya dem.
But naw, di whole eart dey rest;
get peace and evribody dey sing with happiness.
Cypress trees and cedars for Lebanon dey happy bikos di king don fall,
so nobody go kut dem trowey again.
Pipol wey don die, dey happy to welkom Babilon king.
Pipol wey dey strong well-well wen dem dey life,
dia ghost dey wait am
and all di former kings ghost raiz from dia throne
dey wait am too.
10 All of dem dey sey,
‘Naw, yu don dey weak like us! Yu don bi like us!
11 Before-before, dem dey play music with harp to give yu respet,
but naw, yu dey with dead pipol.
Yu liedan for worm bed
kon use di worms take do kover klot.’ ”
12 Babilon king, yu wey bi di morning star wey dey shine;
make yu si as yu fall from heaven, just as devil fall!
Before-before, yu katch many pipol,
but naw, dem don trow yu for groun.
13 Yu bin tell yorsef sey,
“I go klimb go heaven
go put my throne on-top di highest stars.
I go sidan and rule like king
for di highest mountin.
14 I go klimb go di place wey high pass for di kloud.
I go bi like di Most High God!”
15 But God don bring yu down to di place wey deep pass
and na der dead body dey stay.
16 Dead body dem go look yu kon ask demsef,
“Nor bi dis man bin dey shake di eart
kon make kingdoms dey fear?
17 Nor bi dis man distroy towns kon turn di world to desert?
Yes! Na di man nor gri free en prisonas make dem go dia house!”
18 And all di kings for di world
liedan for dia grave,
19 but yu nor get grave,
just like bullet wey dem shot trowey.
Yor dead body just dey groun
with oda pipol wey dem kill with swod;
with pipol wey dem won go trow dia dead body for pit.
20 Dem nor go beri yu like oda kings,
bikos yu distroy yor own land kon kill yor pipol.
Nobody from yor wiked family go survive.
21 Make dem bigin kill di king sons,
bikos of dia grand-grand papa sin.
No one among dem go rule for dis world
or build towns again.
God Go Skata Babilon
22 God wey get pawa sey,
“I go attack and skata Babilon.
I nor go leave anytin or pesin for der;
nobody go survive at-all and pipol nor go remember am again.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.
23 I go turn Babilon to where birds and wild animals dey stay
and wota wey nor dey go front or back, go full di land.
I go swip am trowey,
just as pesin dey use broom take swip dirty trowey.”
God Go Distroy Assyria Pipol
24 God wey dey lead heaven sojas swear sey,
“Make una know sey na as I plan am,
na so e go bi and as I tok am,
na so e go happen too.
25 I go distroy Assyria pipol for my land.
I go skata dem put under my hill.
I go free my pipol and remove di load
wey Assyria pipol put for dia shoulder.
26 Dis na wetin I plan for di whole eart;
my hand dey ready to ponish di nashons.”
27 True-true, God wey dey lead heaven sojas get plan
and who go fit stop wetin E won do?
En hand dey ready to ponish anybody.
So who go fit stop am?
God Go Distroy Filistia Pipol
28 Na for di year wey King Ahaz die,
God take send dis message:
29 Filistia pipol, di kane wey dem take flog una don break,
but make dat one nor make una dey happy.
If one snake die, di one wey bad pass go take-ova,
bikos na dragon go fly kom out from di snake egg.
30 Na God dey guide and save poor pipol.
But E go make honga kill Filistia pipol finish.
31 Filistia towns!
Make una shaut and kry for help.
Make una fear, bikos betta smoke dey kom meet una
from nort and dem bi strong sojas wey nor dey fear.
32 How una go take ansa di messenjas wey dey
kom meet una from Filistia land?
True-true, God don make Zion great and en pipol wey dey sofa,
go dey save for der.