18
God Go Ponish Ethiopia
E go bad well-well for Ethiopia,
di land where bird feada for dey make nois for river,
where messenjas dey travel pass with boat
wey dem take soft wood make.
Di messenjas go meet pipol wey tall and get smooth skin;
pipol wey dem dey fear for evriwhere;
wey dia nashon dey strong and always dey win war
and wey river divide dia land.
Make evribody wey dey for di world, listin!
Una go si one flag on-top di mountin,
den una go hear one trumpet sound,
bikos dis na wetin God tell mi,
“Just as dew dey form for nite wen harvest time rish
and as sun dey shine for day time kon make evriwhere hot,
na so too I go kwayet dey look una from heaven where I dey stay.
And before dem go gada di grapes wey don ripe
afta di new leaf don fall,
I go use my knife take kut di branches wey nor dey produce fruit
kon break all di bad branches.
Dem go leave all di dead body for groun,
so dat birds and wild animals go chop dem.
Birds go chop dem for dry sizin
and wild animals go chop dem for rainin sizin.”
For dat time, di pipol wey tall and get smooth skin,
wey pipol dey fear for evriwhere;
wey dia nashon dey strong and always dey win war
and wey river divide dia land,
go kom pay respet to God wey dey lead heaven sojas.
Dem go kom honor God wey dey lead heaven sojas
for di place wey E choose to stay for Mount Zion.