19
God Go Judge Egypt
Dis message na about Egypt:
Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt.
Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.
God sey, “I go make war happen for Egypt, dat time,
broda go fight against broda
and neighbour go fight against neighbour.
Town go fight against town
and kingdom go fight against kingdom.
I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles.
Dem go-go meet dia juju for help
kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.
I go give Egypt pipol to one bad ruler and na wiked kings go rule dem.
Mi wey bi God wey dey lead heaven sojas, don tok.”
River Nile go dry
and all di oda river for Egypt go dry finish.
Di place where di river dey flow from go dey smell
and all di rivers go dry.
All di plants wey dey float on-top di river, go dry;
evritin wey dem plant near River Nile
go die and breeze go blow dem trowey.
Fishermen go kry well-well.
Yes! Pipol wey dey katch fish der
and doz wey dey trow net for di river,
go dey kry with pain.
Pipol wey dey make linen klot,
go konfuse well-well and dem nor go know wetin to do.
10 Pipol wey dey weave and doz wey dem hire to work,
go taya and weak well-well.
11 Zoan leaders na fools!
Wise men for Egypt dey give di king yeye advise,
if not, wetin go make yu tell Fero sey,
“I dey among doz wey sabi rite
and wi dey plan to ova-trow yu?”
12 And naw, where doz wise men wey dey advise di king?
Make dem kon tok evritin wey God dey plan to do for Egypt na!
13 Zoan and Memfis leaders na fools.
Na dem suppose lead di nashon, but bikos dem nor know di rite way,
dem dey lead di pipol anyhow.
14 God don konfuse dem; dem dey give wrong advise and evritin wey Egypt pipol dey do,
nor dey rite at-all and naw,
di pipol dey stagga like drunkard man wey sleep on-top en vomit.
15 So, work or any betta tin nor go dey Egypt again;
weda na for di leader or di ordinary pipol
or di rish and di poor.
Egypt Go Woship God
16 For dat time, Egypt pipol go bi like wimen. Dem go shake dey fear bikos Oga God wey dey lead heaven sojas don dey ready to ponish dem. 17 Den Judah pipol go sofa Egypt pipol and anybody wey go hear Judah pipol story, go dey fear, bikos of wetin God wey dey lead heaven sojas won do dem.
18 For dat time, five towns for Egypt go dey speak Kanaan language kon promise to serve God. Dem go koll one of di town, “Sun town.”
19 For dat time, dem go build one altar for God for di middle for Egypt, with one holy pila wey dem go dedikate give God for Egypt boundary. 20 E go dey remind pipol for Egypt about God. Wen dem dey opress di pipol and dem koll God make E kom help dem, E go send pesin go diliver and help dem. 21 God go show ensef to Egypt pipol; dem go woship am with ofrin and sakrifice kon know am well-well. Dem go promise God and do wetin dem promise. 22 Even doh God go ponish Egypt pipol, E go still heal dem again. Dem go turn to am and E go hear dia prayer kon heal dem.
23 Wen dat time rish, betta road go dey between Assyria and Egypt. Pipol for di two kountry go dey travel go visit each oda and di two nashon go woship togeda. 24 Wen dat time rish, Israel pipol go bi di same with Egypt and Assyria pipol and dis three nashon go bi blessing to di whole world. 25 God wey get pawa go bless dem kon sey, “Egypt wey bi my pipol, I go bless una. Assyria pipol wey I kreate and Israel pipol wey I don choose, I go bless una well-well too.”