20
Naked Profet
God give dis message for di year wen King Sargon for Assyria send en kommander go fight and konker Ashdod. For dat time, God tok to Isaya wey bi Amos pikin sey, “Make yu remove di sak wey yu wear and di sandal wey dey yor leg.” So e obey God kon waka naked without sandal for leg too.
Afta dem seize Ashdod town, God sey, “Isaya wey bi my savant naked dey waka about for three years naw. Dis na sign about wetin go happen for Egypt and Ethiopia. Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol. Pipol wey trust Ethiopia and bilive sey Egypt go save dem, go fear and shame go katch dem. For dat time, pipol wey dey stay near di river go sey, ‘Si wetin don happen to di place where wi bin put awa hope; so na where wi go run go make dem help us naw? Na where wi dey espect sey, wi go dey save from Assyria king? How wi go fit take eskape naw?’ ”