22
Message About Jerusalem
Dis message na about di Vishon Valley:
Wetin dey happen?
Wetin make evribody dey klimb go on-top roof?
Di whole town dey make nois anyhow.
Una pipol wey die, nor die for war,
but na honga kill dem.
Una leaders run, but dem katch dem
without any fight or sey dem shot arrow.
Even wen di pipol try to run, dem still katch dem too.
So I kon sey, “Make nobody hold mi;
make una allow mi kry well-well.
Make I kry for my pipol,
bikos dem don distroy dem and nobody dey to help dem.”
But awa Oga God wey dey lead heaven sojas get di day
wen E go kause wahala and konfushon for Vishon Valley
and evribody go beg make di mountins kom help dem.
Sojas ride horse from Elam land kom
and dem karry bows and arrows.
Sojas from Kir don dey ready to fight too.
Na shariot full Judah valley wey good well-well.
Strong Sojas stand for Jerusalem gate.
Nobody dey defend Judah town again;
all di pipol wey dey der don fall
and dia sojas don run go bring dia swod
from where dem hide dem put.
Una si all di wall wey dem break for David Town.
Una store wota for di pool wey dey bottom.
10 Una kount di house for Jerusalem kon skata some house,
so dat una go fit si tins wey una go take ribuild di walls.
11 Una make somewhere inside di town where una
go dey store wota wey dey flow kom from di old pool.
But una nor trust God wey make am.
Una nor gri depend on God wey make all dis tins.
12 For dat time, Oga God wey dey lead heaven sojas
kon sey make una dey kry,
mourn, shave una hair and wear sak klot.
13 But instead, una bigin laf and dey do party.
Una sey, “Make dem kill sheep and melu make wi chop
and make wi drink plenty wine!
Make wi drink and chop,
bikos wi go fit die tumoro.”
14 But dis na wetin Oga God wey dey lead heaven sojas tell mi, “True-true, as long as dem dey alive, I nor go forgive dem dia sin.”
Mi wey bi God wey get pawa, don tok.
Dem Warn Shebna
15 God wey get pawa wey dey lead heaven sojas, dis na wetin E tok,
“Go meet Shebna wey dey manage di royal house
kon tell am,
16 ‘Who give yu di rite to stay here?
Wish of yor family memba dem beri for here?
Who give yu rite to won dig grave for yorsef for here?
Yu dey karve grave for yorsef inside di rock.
17 Yu dey feel sey yu dey important,
but God go pick yu trowey for bush.
18 E go pick yu like ball kon trow yu
go anoda land wey far well-well.
Yu go die for der near di shariot
wey dey make yu karry body anyhow.
Yu bi disgrace for yor oga house.
19 God go remove yu from yor pozishon.
E go trow yu komot from yor ofis.’ ”
20 God kon tell Shebna, “For dat time, I go koll my savant, Eliakim wey bi Hilkaya pikin 21 kon gi-am yor robe, di belt and all di pawa wey yu get. E go bi papa wey go dey protet Jerusalem and Judah pipol. 22 I go put David house key for en hand. Wen e open any door, nobody go fit lock am and wen e lock any door, nobody go fit open am. 23 I go nail am like peg for one strong place and e go bring honor and respet kom en papa family. 24 En whole family go dey popula bikos of am, dat is evribody wey rilate to am, go dey popula. Bikos of am, en family go balance like plate and pot wey dem hang for wall.
25 “For dat time, di peg wey bin dey der before, go fall for groun, den evritin wey hang on am, go skata.”
God, wey dey lead heaven sojas, don tok.