23
God Go Judge Tyre
Dis message na about Tyre pipol.
Una wey dey drive ship,
make una kry with pain.
Dem don skata una house
and dem tell una di news as una ship dey kom from Cyprus.
Make una kry! Una wey dey stay near river
and una wey bi tradas for Sidon,
men wey dey travel round sea,
go sell food wey dem harvest for Egypt
and dey do business with pipol for oda kountry.
Sidon pipol, make shame katch una,
bikos sea and ocean don rijet una kon dey sey,
“Wi neva feel pain like woman wey won born
or sey wi don born pikin before;
wi neva even train shidren before.”
Even Egypt pipol go sopraiz well-well
wen dem hear evritin wey happen for Tyre.
So, Foenicia pipol wey dey stay near di sea,
make una kry well-well!
Make una run go Tarshish!
Una sure sey dis na Tyre,
di town where dem for dey celebrate since?
Town wey God kreate,
wey en pipol dey difren place for di world?
Who bring all dis wahala kom Tyre wey en pipol na prince
and wey pipol dey respet dia tradas well-well for di world?
Na God wey dey lead heaven sojas do am.
E do am to stop dia pride
and to ponish dia pipol wey oda pipol dey respet.
10 Una wey dey Tarshish,
make una travel go back to una land,
just as pesin dey cross River Nile,
bikos Tyre don skata.
11 God stresh en hand go di sea kon konker kingdoms,
den kommand make dem distroy all di strong town for Kanaan.
12 God sey, “Sidon town,
una joy don end and dem go opress una.
Even if una run go Cyprus,
una nor go dey save for der.”
13 Make una si Kaldean town,
pipol wey nor know where dem from kom!
Assyria pipol don turn di land to where wild animals dey stay.
Dem don skata dia towas,
distroy dia strong town
kon turn am to where dem dey trow dirty put.
14 So, una wey dey drive big ship,
make una kry well-well,
bikos dem don distroy di town
where una for bin dey save.
15 For dat time, dem go forget Tyre for seventy years, wey bi di normal years wey king suppose stay for dis world. Wen dat time don pass, pipol go know Tyre again and e go bi like di ashawo wey dey dis song:
16 “Make una take di harp kon go round di town,
una wey bi ashawo wey dem don forget!
Make una play and sing una song,
so dat men go kom meet una again.”
17 Wen di seventy years don pass, God go make Tyre strong again. Di town go kon rish and go dey sell tins give all di oda kingdoms. 18 Di profit wey dem go make, dem go gi-am to God. Dem nor go keep di money or allow am many for one place, but dem go give di profit to pipol wey always dey stay God present and dis pipol go use am take buy enough food and fine-fine klot wey dem go wear.