27
God Go Kill Di Dragon
For dat day,
God go use en great and pawaful swod
take ponish and distroy Leviatan;
dat dragon wey dey twist and waka fast-fast.
Yes! God go kill di great monsta
wey dey inside sea.
Wen di time rish,
make una sing about God vineyard!
“Na mi wey bi God go protet am,
I dey always look and wota am.
I dey guide am both for day and nite,
so dat nobody go skata am.
I nor dey vex for di vineyard again.
If enemies won attack my pipol,
I go mash go fight and burn dem with fire.
But if my pipol enemies wont make I protet dem,
make dem make peace with mi.
Yes! Make dem make peace with mi.”
Time dey kom wen Jakob shidren-shidren go get rut
like tree and dem go grow well.
Di fruit wey dem go bear, go full di eart.
God don distroy Israel pipol,
just as E do doz wey dey opress dem?
E don kill Israel pipol as E kill dia enemies?
No, but God vex for en pipol
kon send dem go Babilon as dia ponishment.
E karry dem komot from dia land
with one strong breeze from di east.
So like dis, God go forgive Jakob shidren
and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again.
Dem go skata all di stone for dia juju altars
kon distroy Asherah juju and all di incense altars.
10 Naw, dem don distroy all di strong towns.
E empty and e don turn desert where animals
for dey kom look for food chop.
11 Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun;
wey wimen dey gada take do firewood.
So, bikos di pipol nor undastand anytin,
God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
12 Di time dey kom wen God go shake di tree from Eufrates River go rish di rut for Egypt and just as farmer dey separate korn from dia kanda, na so too God go gada and separate en pipol one-by-one. 13 Wen dat day rish, dem go blow one loud trumpet, den Israel pipol wey dem katch go Egypt and Assyria go kom back kon woship Oga God for en holy mountin for Jerusalem.