30
Yuzles Agriment With Egypt
God sey,
“I go ponish my shidren wey
nor dey obey my kommand.
Pipol wey dey do wetin dem like
and enter agriment
with wiked pipol
kon dey do tins without my Spirit.
Dem just dey add join dia sins.
Only dem go Egypt for proteshon kon beg Fero make e guide dem,
even doh I nor send dem.
But na shame una go get from Fero proteshon,
bikos Egypt pipol nor go fit help una at-all.
Aldo, Egypt leaders dey Zoan
and dia ofisas dey kom from Hanes,
God go disgrace Israel pipol,
bikos dis pipol nor fit help dem.
Dem nor go fit help dem at-all,
instead na shame and disgrace dem dey bring.”
Dis message na about di animals for Negev:
For der, di pipol pak dia propaty and money on-top donkey
kon travel pass one land wey wahala and trobol full;
where lions, snake and oda wiked animals dey stay.
Dem travel go meet pipol wey nor go fit help dem.
Egypt pipol nor go fit help dem at-all
and bikos of dis, I koll di land,
“Nashon wey dey make mout, but dem nor get pawa.”
Naw, make yu go rite am down for dia present;
rite am for one book so dat dem go fit keep am wait
dia shidren-shidren make dem for know wetin happen.
Bikos dis pipol sturbon and dey lie well-well;
dem bi shidren wey nor gri obey God law.
10 Dem tell di pesin wey dey si vishon sey,
“Make yu nor si any vishon for us”
and dem tell di profet sey,
“Make yu nor tell us di rite tin again!”
Dey tell us betta and sweet tins.
Make yu just dey lie give us.
11 “Nor do good again, but make yu kom join us.
Make yu nor tell us about di Holy One for Israel again.”
12 Bikos of dis, di Oga wey bi God for Israel sey,
“Una don rijet dis message kon bilive una pawa
wey bi to opress and deceive pipol.
Yes! Una really love una bad karata.
13 So na dis sin go distroy una.
Una go bi like high old wall wey don krack
and wey go soon fall and na wons e go fall.
14 E go skata for groun like pot wey break to pieces
and nobody go fit pick or arrange am again.”
15 Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok:
“I wish sey una gri turn from sin kom meet mi
kon dey wait with patient, I for diliver una;
if una kwayet, dey wait mi,
I go give una strent and pawa, but una nor gri wait.
16 Instead, una sey, ‘No! Wi go enter awa horse kon run,’
and true-true, una go run.
Una sey, ‘Wi go run with di horse wey fast pass,’
but doz wey dey porshu una, go fast pass una.
17 Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una,
den wons una si five of una enemies sojas,
all of una go run until una nor many again
kon small like poles wey dey on-top mountin
or sign flag wey dey on-top hill.”
God Nor Go Leave En Pipol
18 Bikos of dis, God dey ready to pity for en pipol;
E sidan for en throne and E dey ready to forgive una.
True-true, God dey good and evribody wey get faith
and dey wait am, go happy well-well.
19 Una go stay for Zion! Jerusalem pipol nor go kry again. Wen God hear as una dey kry with pain, E go kom save and help una. Yes! E go ansa wen una kry for help. 20 Aldo, God go give una sofa chop like food kon make una drink pain una; but E go still dey with una to tisha una. Una go si una tisha with una own eye. 21 Una go hear one vois dey tok from una back sey, “Na di korrect way bi dis, make una waka pass der,” weda una dey waka go rite or left. 22 Una go distroy una juju wey dem make with silva and gold. Una go trowey dem like rag wey dem take klean groun kon sey, “Make una take dem komot here.”
23 God go pour wota put for di seed wey una plant and di groun go produce plenty food for una. For dat time, una animals go chop betta green grass for field. 24 Di melu and oda animals wey una take dey work for una field, go dey chop betta-betta food. 25 For dat time wen dem kill pipol well-well and di towas don fall, wota go dey flow kom from evry mountin and hill. 26 Full moon lite go shine like sun for aftanoon and sun lite go shine seven times pass as e dey shine before and e go bi like seven days lite. Den God go join en pipol bones wey bin break kon heal all dia wound.
27 Si! God dey kom from far with strong vexnashon and great glory.
E dey vex dey tok and en words bi like fire wey dey distroy tins.
28 Wen E shaut for war,
e bi like river wey dey distroy tins
or wey kover pesin rish en neck.
E go shake di pipol like tray wey dem take
dey separate rice from en kanda.
E go put rope for dia mout kon distroy dem.
29 But una go sing just as una dey do
wen una dey do festival for evening;
una go happy like pesin wey dey blow trumpet
go woship for di Oga God mountin;
di God wey dey protet Israel.
30 God go shaut well-well kon fight with pawa.
Yes! E go vex kom with fire wey dey distroy,
heavy rain and with big-big stone wey dey fall from heaven.
31 True-true, God vois go skata Assyria pipol,
E go distroy dem with en rod.
32 Evry blow wey E give dem,
Israel pipol go support am with music from dia trumpet
and jita and E go attack dem with en swod.
33 Dem don already prepare di place
where dem go beri Israel enemies put;
dem don make am deep and wide for dia king.
Dem don gada di firewood
and God breath wey bi like fire and sulfur,
go kom like river wey dey flow kon distroy en enemies.