31
God Go Protet Jerusalem
Pipol wey dey go Egypt for help,
curse dey dia head!
Dem dey put dia hope for di plenty sojas,
ordinary horse and shariot wey Egypt get.
But dem nor trust Israel God
or kom meet am make E help dem!
God wise well-well! E dey do just as E tok.
E go ponish wiked pipol
and doz wey dey enkourage pipol to sin.
Egypt pipol nor bi god!
Dem bi ordinary human being.
Dia horse na just flesh nor bi spirit!
God go distroy dem with en hand.
Di pipol wey dey help dem, go stagga and di ones wey dem dey help,
go fall for groun and all of dem go die togeda.
God Go Defend Zion
True-true, dis na wetin God tell mi,
“Like lion wey dey shaut with vexnashon
or yong lion wey won chop wetin e kill,
na so I go bi like. Even doh many shepad gada round di lion,
e nor dey fear dia shaut or run from dem.
Na like dis too, Oga God wey dey lead heaven sojas,
go kom help Mount Zion.
Just as bird dey fly round en house make e for protet en shidren,
na so too God go protet and defend Jerusalem.”
God sey, “Israel pipol, una don sin and oppoz mi, but make una turn from sin kom meet mi! Bikos I know sey di time go kom wen all of una go trowey di juju wey una use gold and silva take make.
“Dem go kill Assyria pipol with swod for war
and nor bi swod wey human being make.
Assyria pipol go run from di swod
and dem go turn dia yong men to slaves.
Dia king go run komot from en palis bikos of fear;
dia ofisas go dey fear wen dem si God war flag.”
Dis na God word;
di One wey en fire dey burn well-well for Mount Zion.