33
Prayer For Help
Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die,
bikos nobody spoil am.
Di pesin wey dey deceive odas nor betta pass who don die,
even doh nobody deceive am.
Wen yu don spoil and deceive pipol finish,
oda pipol go spoil and deceive yu too.
So my God, make Yu sorry for us,
bikos na Yu wi put awa hope on.
Make Yu dey protet us evriday
kon save us from trobol.
Wen Yu fight for us,
nashons dey run!
Wen dem hear yor nois,
dem dey run skata.
Awa enemies propaty dey skata
like plant wey ant chop.
God dey great well-well!
Yes, E dey stay for heaven.
E dey judge Jerusalem pipol well-well.
Na-im dey make en pipol strong
kon make dem dey save.
E dey protet and give dem wisdom and na only doz wey dey fear am,
E dey do all dis tins for.
Si, pipol wey dey ripresent kountries dey kry
and doz wey dem send to go make peace,
dey sorry for demsef.
Di main road dey empty,
bikos nobody dey travel again.
Kontries dey break di agriment wey dem make
with each oda and pipol
nor dey respet one anoda again.
Di land don dry and nor-tin dey inside again.
Lebanon forest don dry finish;
Sharon valley bi like desert naw
and di trees for Bashan and Karmel mountin don dry finish.
God Warn En Enemies
10 God tell di nashons sey, “Naw, I go get up!
I go show how my pawa big rish kon make una respet mi.
11 Una just dey make yeye plans
and evritin wey una dey do, dey yuzles.
Di air wey una dey breath,
na fire wey go distroy una.
12 Una go skata like rocks wey dem dey burn take make lime;
like shuku-shuku wey dey burn to ashes.
13 So make evribody wey dey near and far hear wetin I don do,
so dat dem go know how my pawa bi.”
14 Zion pipol wey dey sin, dey fear!
Pipol wey nor dey fear God, dey shake.
Dem sey, “E get any one of us
wey fit survive dat kind fire?”
15 Di pesin wey dey do and tok wetin dey rite;
wey nor dey shit poor pipol,
bikos e get pawa and wey nor dey take bribe,
join doz wey kill pipol or join do bad tins,
16 na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well.
E go get food and wota to chop and drink.
Betta Tumoro
17 E nor go tey again before una go si one good king wey dey rule well
with one kingdom wey big and wide well-well.
18 Una go remember all di wahala wey una face before,
den una go ask unasef,
“Where dem rite dis tins put?
Where di pesin wey dey hold di money?
Where di pesin wey dey kount di towa?”
19 Una nor go ever si sturbon pipol
wey go dey speak language wey una nor undastand again.
20 Instead, una go si Zion,
di town where wi for dey celebrate awa festival.
Una go si Jerusalem too!
E go dey save well-well and pipol go stay der!
E go bi like tent wey dem nor dey karry komot from where e dey;
tent wey dem nor dey pul en peg from groun
and en rope nor go kut.
21 True-true, God go rule for der as awa king.
River wota go dey flow pass awa land.
No war ship or big ship go drive pass am.
22 Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king,
go diliver us.
23 For dis time, all awa enemies ship rope don slak;
di ship don weak well-well!
Wi go seize all di propaty wey awa enemies sojas get
kon divide dia propaty among doz wey nor fit waka.
24 Nobody for Zion go sey, “I know well or I dey sick”,
di pipol wey dey der, God go forgive dem dia sins.