34
God Go Ponish En Enemies
Pipol from evry nashon,
make una kom!
Make una gada kon listin.
Make evribody for di world listin.
God dey vex for all di nashons and dia sojas.
E go kill and distroy dem.
Nobody go beri dem; dem go rotin for groun.
Dem go dey smell for evriwhere and dia blood go kover di mountins.
All di stars go vanish komot, di sky go disappear like book wey dem klose
and di stars go fall like dry leaf wey fall from vine or fig tree.
God dey ready with en swod for heaven and E go kut Edom;
doz pipol wey E won kondemn and distroy.
Na dia blood and flesh full God swod like sey na lamb,
goat or animal wey dem take do sakrifice.
God go do dis sakrifice for Bozrah town
and E go kill Edom pipol well-well for di land.
God go kill dem with all dia animals.
Blood go kover dia land and di pipol flesh go kover evriwhere.
God don plan di day wey E go revensh Edom pipol
for all di bad tins wey dem do en pipol, Israel.
Edom rivers go turn black like shako and di land go turn to sulfur.
Di whole kountry go black like shako too.
10 E go dey burn both for day and nite and smoke go dey
kom out from am forever.
Nobody go ever fit stay or travel pass di land
from one generashon go rish anoda.
11 Na owls and ravens go dey stay di land.
God nor go let am bear fruit again,
just as e dey bear before wen God kreate di world.
12 En kings and leaders nor go get anywhere to koll dia kingdom again
and all en ofisas go disappear.
13 Shuku-shuku go grow full dia farms;
jackals and owls go dey stay for di town.
14 Na for der doz animals for desert go dey do meetin;
wiked goat go dey koll demsef for der
and na der too doz wiked animals for nite,
go dey kom rest.
15 Wiked bird go build dia house, lay eggs,
born dia shidren and kare for dem for der.
Vulture go gada for der one-by-one.
16 So make una take time take read God book!
No one among dis animals go miss and all of dem go get dia patina.
God don kommand and en ensef go bring dem togeda with en Spirit.
17 Na God go divide di land give dem
and E go give evribody di one wey rish am.
Dem go stay for di land from one generashon
go rish anoda one.