39
Messenja From Babilon
For dat time, King Merodak-Baladan wey bi Baladan pikin, for Babilon kon hear sey King Hezekaya dey sick since, so e send leta and gifts go gi-am. King Hezekaya welkom di messenjas kon show dem en propaty, silva, gold, spices, perfumes and evritin wey en sojas dey use for war. E nor get anytin for en store room or kingdom wey e nor show dem.
Den Profet Isaya go meet King Hezekaya kon ask, “Where dis men from kom and wetin dem wont?”
King Hezekaya ansa, “Dem kom from Babilon wey far well-well.”
Di Profet ask, “Wetin dem si for di palis?”
Di king ansa, “Dem si evritin, e nor get anytin for di store room wey I nor show dem.”
Profet Isaya kon tell di king, “God wey get pawa sey, ‘Time dey kom wen dem go karry evritin wey yor grand-grand papa dem keep kon rish naw go Babilon and nor-tin go remain. Dem go still karry some of yor own shidren-shidren go do slave work for di king palis for Babilon.’ ”
King Hezekaya undastand sey, as long as e dey alive, peace go dey for di town, so e ansa, “Di message wey yu give mi from God so, dey good.”