40
Word Wey Dey Give Hope
Awa God sey, “Make yu konfort my pipol!
Konfort dem well-well!
Give Jerusalem pipol heart.
Tell dem sey dem don sofa rish and God don forgive dem dia sins.
Yes! I don ponish dem well-well for dia sins.
One vois dey kry sey,
Prepare one road for di wildaness for God!
Make una klear di road for di desert for awa God!
God go raiz-up evry valley and E go level evry mountin and hill.
All di bend-bend road go strait and di rof place go smooth.
Den God glory go kom out and evribody go si am,
bikos God don tok am with en own mout.”
One vois dey kry sey, “Make yu prish one message!”
So I ask, “Wish message I go prish?”
Di vois ansa, “Make yu prish sey all men na grass;
let dem know sey dem nor dey last pass flower wey dey bush.
Grass dey dry and flowers dey fade wons God send strong breeze go blow dem.
Na so too pipol nor dey last pass grass.
Yes, di grass go dry and flower go fade,
but awa Oga God word go dey forever.”
So Jerusalem, make yu go on-top high mountin.
Make yu prish di good news!
Koll Zion pipol with loud vois,
den announce di good news!
Shaut as yu dey tok and nor fear at-all.
Make yu tell Judah towns sey God dey kom!
10 God wey dey mighty dey kom rule with pawa
and E dey bring di pipol wey E don save with am.
11 E go kare for en animals just as shepad dey do.
E go gada di lamb togeda kon karry dem for en hand;
E go lead and guide dem.
Israel God
12 E get anybody wey fit pak wota for hand kon measure am?
Abi who fit measure di sky?
Abi anybody don fit weigh all di san for di eart
or weigh di mountins and hills with skale?
13 E get anybody wey fit tell or tish God wetin E go do?
Abi pesin dey wey go advise God?
14 Who God dey go ask make E for fit undastand
how E go do tins?
15 Si, di nashons nor mean anytin to God,
dem bi like one drop of wota.
Di island wey dey for far nor heavy
rish dust for God hand.
16 All di animals wey dey for Lebanon forest
nor rish to take offa sakrifice for God and all di trees
nor plenty rish to take make fire for di sakrifice.
17 All di nashons nor mean anytin to am at-all.
For God eye, dem nor mean anytin at-all.
18 Who dem go fit use take kompare God?
How yu go fit take diskribe who God bi?
19 E nor bi like juju wey man make
or di one wey doz wey dey karve wood kover with gold or put silva.
20 Pesin wey nor fit buy silva or gold
go use wood wey nor go rust
and e go find who sabi di work
make e help am make image wey nor go skata.
21 Una nor know? Dem neva tell una since?
Una neva hear how di world take start?
22 Na di Pesin wey sidan for di throne, make am.
Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky.
Pipol for groun, small like ants for en eye.
E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.
23 Na-im dey make rulers rule with pawa
kon still bring dem down.
24 Dem bi like yong plants wey just dey grow
kom out wey pipol rut trowey.
Wen God send en breeze kom,
di flower dey dry and blow komot like grass.
25 Who dem go fit use take kompare God?
E get anybody wey bi like am?
26 Make una look di sky! Who make di stars wey una dey si?
Na-im dey lead dem like sojas.
E know how dem plenty rish and E dey koll all of dem by dia name!
En pawa big well-well and no one among di stars dey miss.
27 So, Israel pipol!
Why una dey komplain sey God nor know una trobols
or kare if una dey sofa at-all?
28 Una nor know? Una neva hear?
God go dey forever. Na-im kreate di whole world.
E nor dey taya or weak.
Nobody fit undastand wetin E dey tink.
29 E dey give strent and pawa
to pipol wey dey weak.
30 Even yong pipol go taya
and strong yong men go kwik too.
31 But pipol wey dey wait for God to kom help dem
go get new strent and pawa.
Dem go fly high like eagle; even wen dem run,
dem nor go taya and wen dem waka,
dem nor go faint.