41
Wetin God Promise Israel
God sey, “Una wey dey for far land,
make una listin to mi!
Make una kom meet mi
make I give una new pawa!
Make una kom tok to mi;
make wi kom togeda kon setol di matter.
Na who raiz di raitious Pesin kom from east
kon make am stand and rule ova nashons and kings?
With en swod, e turn dem to dust and with en bow,
e make dem bi like grass wey breeze dey blow.
E porshu and pass dem and e nor wound at-all.
Yes! E dey kom with full speed.
So, na who do all dis tins? Na who tok how generashon go bi?
Na mi wey bi God; na mi bi First and na mi bi Last.
Pipol from far place si wetin I do and fear katch dem;
di whole eart dey shake; all of dem gada dey kom fight.
Dem dey enkourage and tell each oda sey,
‘My broda, nor fear; make yor heart strong.’
Di karpenters among dem dey enkourage doz wey dey make gold
and di man wey dey karve di juju
dey tell di one wey dey nail am togeda sey,
‘I like as yu nail am strong so, bikos e nor go fall.’
God Enkourage En Pipol
“But Israel na my savant!
Di pipol wey I choose, wey bi my friend Abraham shidren-shidren;
pipol wey I koll and bring back from where di world for end kon sey,
‘Una bi my savant. I don choose una and I nor go rijet una.’
10 So make una nor fear, bikos I dey with una!
Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear!
I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
11 Pipol wey dey vex with una,
go know how pesin dey shame rish wen dem don defeat am.
Pipol wey dey fight against una,
go die
12 and dem go disappear komot from dis eart.
13 Na mi bi di Oga wey bi una God
and I dey enkourage una sey,
‘Make una nor fear, bikos I go help una.’ ”
14 God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish,
make una nor fear,
bikos I go help una.
Mi wey bi Israel God wey dey holy,
na mi bi di only Pesin wey go save una.
15 I go make una bi like new swod wey get sharp korna.
Una go distroy all una enemies and di mountins
and hills go skata for groun like dust.
16 Una go blow dem and breeze go skata
and karry dem go.
Una go dey happy, bikos na mi bi una God,
den una go praiz mi wey bi Israel God wey dey holy.
17 Wen poor pipol and doz wey dem dey opress dey look for wota
bikos dia trot don dry, den mi,
wey bi God go ansa dem.
Israel God nor go ever abandon dem.
18 I go make river flow from dry hill and wota go flow for valley.
I go turn di desert and di dry land to where wota full.
19 I go make cedar, akacia, myrtle and olive trees grow for di desert.
Forest wey pine, junipa and cypress trees dey,
go grow for dry land where tree nor suppose grow.
20 Pipol go si dis tins and dem go know sey,
na mi wey bi God, do am.
Den dem go undastand sey,
na Israel God wey dey holy, make all dis tins happen.”
God Nor Wont Juju
21 God wey bi Israel pipol king sey:
“Di gods for di nashons, make una tok wetin dey una mind.
Make una kom defend unasef!
22 Make una tell us wetin go happen,
so dat wi go know before e happen.
Make una tell us di tins wey una don tok before,
so dat wi go shek dem kon si as dem go take happen.
Abi una go tell us about
wetin go happen for future?
23 Make una tell us how di future go bi,
den wi go know sey una bi god!
Make una do sometin wey dey good or wey dey bring wahala.
Make una do tins wey go make us fear!
24 Una with evritin wey una dey do, nor mean anytin.
Na yeye pipol dey woship una!
25 I don choose one pesin from east,
I go bring am kon attack una from di nort
and e go mash una just as pesin wey dey mold tins,
dey mash klay.
26 Make wi know who tok am before e happen,
so dat wi go know sey di pesin dey rite?
True-true, nobody among una tok am!
True-true nobody among una sey na so e go bi!
True-true, nobody even hear wen una dey tok!
27 Na mi God first tell Zion sey,
‘Dis na wetin go happen.’
I send betta news go Jerusalem sey, ‘Una pipol dey kom!
Dem dey kom house back!’
28 Wen I look all di gods, no one get anytin to tok;
no one among dem fit ansa di kweshon wey I ask dem.
29 All dis gods dey yuzles; dem nor fit do anytin at-all.
Di juju dem dey weak and konfuse and dem nor get pawa at-all.”