43
God Promise To Save Israel
Naw, God wey kreate una sey,
“Make una nor fear, I go save una.
I don koll una by una name and una bi my pipol!
Wen una dey pass thru deep wota,
I go dey with una.
Una go fit handle any wahala wey kom una way.
Wen una pass thru fire,
e nor go burn una.
Di temptashon wey go kom,
nor go too hard for una.
Bikos na Mi bi di Oga wey bi una God.
Israel pipol God wey dey holy, wey save una.
I go sell Egypt, Sudan and Seba pipol,
so dat una go dey free.
I go give out many nashons,
so dat una go dey save.
I value una well-well
and I love and honor una.
Make una nor fear,
bikos I dey with una!
I go bring una pipol from east
and west kom house back.
I go tell di nort make dem let dem go
and di sout nor go hold dem for der.
Make my pipol kom
from evriwhere for di world.
Dem bi my own pipol and I kreate dem,
so dat dem go give mi glory.”
Israel Na God Witness
God sey,
“Gada my pipol togeda.
Dem get eyes, but dem nor dey si.
Dem get ear, but dem nor dey hear!
Make all di nashons gada togeda
and make dem bring di pipol kom:
Wish one of dia gods go fit tok wetin go happen for future?
Who among dem bin tok wetin dey happen naw?
Make dem bring dia witness wey go sey dem dey rite
or di pipol wey go kon tell us sey dem tok di trut.
10 Israel pipol, na una bi my witness.
I choose una as my savants,
so dat una go know, bilive and undastand
sey na mi bi di only God.
E nor get any oda god wey dey apart from mi.
E neva dey before and e nor go ever dey.
11 Yes! Na only mi bi God;
di only One wey dey save una.
12 I first tok wetin go happen and den,
I kom save una and know oda god don do like dis before.
Yes! Na una bi my witness.
13 Even before I kreate di day,
I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa.
Na who fit shange or skata wetin I don do?”
God Go Distroy Babilon
14 Israel God wey dey holy, wey save una sey,
“Bikos of una, I send sojas go Babilon
kon break di town gate
and di pipol happiness kon turn kry.
15 Na mi bi una God wey dey holy.
Israel pipol, na mi kreate una and na mi bi una king.”
16 God wey make road pass di sea and where wota dey,
dis na wetin E tok.
17 Di One wey lead strong sojas go distroy Babilon,
dia shariot and dia sojas.
Dem fall for groun and dem nor go raiz again;
dem dey go up like smoke wey dey kom out from lantan!
18 But God sey,
“Make una nor tink about wetin dey happen
or put una mind for wetin don happen before.
19 But naw, I go do new tin;
e go happen and una go si am!
I go make road for di wildaness
kon give una plenty wota for der.
20 Even bad animals go honor mi;
jackals and ostrich go praiz mi
wen I go make river flow for di desert,
so dat di pipol wey I choose go get wota to drink.
21 Na mi form dis pipol for mysef
and dem go sing praiz mi!”
Israel Sin
22 God sey,
“Israel pipol, una bin taya for mi;
una nor gri woship mi.
23 Una nor offa sheep for mi as ofrin;
una nor gri honor mi with una sakrifice.
I neva force una to serve mi with una ofrins
or force una to give mi incense.
24 Una neva buy any incense for mi
or give mi di fat for una animal as ofrin.
Yet una dey wahala mi with una sins
kon make mi dey vex bikos of una yeye ways.
25 But na mi wey bi God still dey forgive una sins
and I do all dis tins, bikos of who I bi!
I nor go kount una sins against una.
26 Make una remind mi of di good wey una do;
make wi tok di matter togeda;
make una tok as una take good.
27 Una grand-grand papa dem wey dey before,
kommit sin.
Una leaders sin against mi
and una rulers stain my temple with blood.
28 So I bring wahala kom Israel;
I do am,
so dat dem go curse and ponish my pipol.”