44
God Go Bless Israel
God sey,
“Make una listin, Israel pipol wey bi my savant
and Jakob shidren-shidren wey I choose.”
Dis na wetin God tok,
“Na mi kreate and form una for una mama belle kon help una,
so make una nor fear,
bikos una bi my savant;
di pipol wey I choose and love.
I go give una wota for dry land
kon make wota flow pass where wota nor dey.
I go put my Spirit for una shidren body
kon bless una shidren-shidren.
Dem go grow like grass for di field,
like tree wey dey where wota dey flow pass.
Den, one among dem go sey,
‘I bi God own.’
Anoda one go sey
‘I bi Jakob pikin.’
and anoda one go rite God name
put for en hand kon sey,
I dey among God pipol
and my name na Israel.”
God wey dey rule and protet Israel pipol;
di Pesin wey get pawa sey,
“Na mi bi di First and di Last;
e nor get any oda god apart from mi
wey bi di Almighty God.
E get anybody wey bi like mi?
Make e tok am!
Make e kom out kon make mout for my front
about wetin don happen since I kreate dis world
and wetin go still happen!
Yes, make e tok wetin go happen.
So my pipol, make una nor fear or shake!
Una know sey from biginnin kon rish naw,
I always dey tok di tins wey go happen
and una bi my witness.
E get any oda god apart from mi?
E nor get any oda god, wey get pawa.
I neva si or hear about any one?
To Serve Juju Na Sin
“Pipol wey dey make juju nor mean anytin
and di juju wey dem tink sey dey give dem happiness,
nor mean anytin at-all.
Di pipol wey dey serve di juju nor dey si
and dem nor know anytin;
so na shame and disgrace go follow dem.
10 Na only fool go make en own god
– yeye god wey nor go fit help or fight for am.
11 Si, shame go follow evribody wey dey woship dat god,
bikos na human being make am.
So make dem kom make wi judge di kase,
den una go si sey,
fear go katch dem and dem go disgrace demsef.
12 Blacksmit dey melt iron for fire.
E go nak am with hammer until e get di shape wey e wont
and na en strong hand e take dey make am.
Wen e hongry, e go kon weak.
If e nor si wota drink, e fit faint.
13 Na so too, karpenter dey measure wood
kon draw as e wont make e bi,
den e go karve am like human being
and put am for en shrine.
14 E kut cedar tree,
kollect oak or cypress tree and oda tree from forest.
E plant cedar seed
and rain kon make am grow,
15 den pesin go kut and take am
make fire kon warm ensef.
Yes! E go make fire from am
kon bake bread too!
E still use some take make juju
kon woship and bow to am.
16 E use some of di wood
take make fire and roast meat chop beleful.
Den e go warm ensef kon sey,
‘My body dey warm bikos of di heat from di fire!’
17 Den e use di wood wey remain take make juju kon bow woship and pray gi-am sey, ‘Na yu bi my god, so make yu kom save mi!’
18 Dis pipol nor get sense and dem nor know wetin dem dey do, bikos dem don klose dia eyes and mind against di trut.
19 Dem nor tink or rizin sef sey, ‘I dey burn some of di wood take bake bread and roast meat chop. Yet, I dey use dis same wood make juju and woship am?’
20 E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”
God: Di Creator And Savior
21 God sey,
“Israel pipol, make una remember sey una bi my savant
and I nor go ever forget una.
22 I don remove una sins komot like sey na tick kloud.
So make una turn kom meet mi,
bikos na mi bi di Pesin wey save una.”
23 Heavens, make una shaut dey happy!
All di deep part for dis eart,
make una shaut well-well!
Make mountins and evry tree for di forest, shaut too,
bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.
God Bless Cyrus
24 Dis na wetin God wey save una,
di Pesin wey form una for una mama belle dey tok:
“Na mi bi God wey kreate evritin.
Na only mi stresh di heavens kom out
kon design di eart as I wont.
25 Na mi dey fool pipol wey dey si vishon
kon make dia work taya dem.
I dey shange wise pipol advise to anoda tin
kon turn dia wisdom to foolishness.
26 But wen my savant tok wetin go happen;
wen I send my messenjas go tell una wetin I plan,
I dey make doz plans, happen.
I tell Jerusalem sey pipol go stay for der again
and dem go ribuild Judah town.
Even doh dem skata am before,
I go raiz am up again.
27 Na mi kommand di sea
make e dry and e dry own.
28 Na mi tell Cyrus sey,
‘Na yu bi di pesin wey go rule;
yu go do wetin I wont make yu do.
Yu go orda make dem build Jerusalem again
kon ribuild di Temple.’ ”