5
Di Vineyard Song
Naw, I go sing to my love;
I go sing about en vineyard.
My love vineyard dey on-top
one hill wey get betta soil.
E build fence round di land kon remove di small-small stones
wey nor go make di vine grow well,
den e plant vine put.
E build one towa for di middle
kon dig pit where e go press di grape put.
But as e dey wait, instead make di grape produce betta fruit,
e kon produce bad ones.
So, my love sey, “Jerusalem and Judah pipol,
make una judge between mi and my vineyard.
E get anytin wey I nor do for dis vineyard?
So, wetin make am dey produce bad grapes,
instead of good grape, just as I espect?
Naw, make I tell una wetin I go do to my vineyard:
I go remove di fence wey dey round am
kon break di wall wey dey protet am.
I go let animals chop and mash am anyhow.
I go let grass grow for evriwhere
and I nor go trim di vine or use hoe dig di groun again,
instead, I go let dirty kover am
and rain nor go ever fall put again.”
Na Israel pipol bi God vineyard,
why Judah pipol na di good vine wey E plant.
E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol.
E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite,
instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.
Pipol Wikedness
Una own don finish!
Una wey dey buy all di house and field join di ones wey una get,
so dat pipol nor go get where dem go stay again.
Naw, na only una go dey di land.
God wey dey lead heaven sojas sey,
“One day, all dis big fine house go skata and
nobody go stay inside again.”
10 True-true, big vineyard go produce only five gallon of wine
and ten basket of seed go produce only one basket of good korn.
11 Una own don finish! Una wey dey wake up for early morning bigin drink.
Una dey drink still evening until di drink katch una well-well.
12 Yes! Una dey play harp, tamborin, flute
and dey drink wine for una party,
but una nor undastand wetin God dey do,
13 so dem go karry una komot una land
bikos una nor undastand.
Una leaders go hongry till dem die
and una pipol nor go si wota drink.
14 Deat go open en mout wide dey wait dem
and all di big and betta pipol
with doz wey dey celebrate for Jerusalem,
go soon enter deat mout.
15 Dem go disgrace evribody
kon honbol pipol wey dey karry body up.
16 Wen God wey dey lead heaven sojas don ponish dis pipol,
dem go praiz am and afta E don judge all of dem,
evribody go know sey Oga God get pawa well-well.
17 Plenty sheep and oda animals go kom
chop grass for di towns wey God don skata.
18 God go ponish pipol wey dey kause trobol with dia sins and lie-lie words;
dem dey use dia hand bring wahala for demsef,
bikos of dia wikedness.
19 Dem dey sey, “Make God kwik do wetin E sey E go do,
so dat wi go si.
Make Israel God wey dey Holy do wetin E plan,
so dat wi go know.”
20 Una own don finish!
Una wey dey sey bad tins, good and good tins, bad
or sey darkness na lite and lite na darkness.
Una dey sey bitter tins sweet and sweet tins bitter.
21 Pipol wey tink sey dem wise and get sense,
bi like doz wey don die.
22 Una own don finish!
Pipol wey bi champion for where dem for dey drink ogogoro!
Dem dey get heart well-well wons e rish to mix difren drinks!
23 Dem dey free pipol wey dey guilty kon opress doz wey dey innocent,
bikos dem don take bribe.
24 So, as straw and dry grass dey burn for fire,
na so too dia life and all di betta tins wey dem get,
go dry and blow trowey,
bikos dem don rijet wetin Israel God wey get pawa, tish us.
25 God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem.
Mountins go shake and pipol wey die,
dem go leave dia dead body for street like dirty.
God vexnashon nor go end for der,
but E go still ponish dem.
26 God dey use sign take koll pipol from far-far nashon.
E dey blow trumpet take koll dem from evriwhere for di world
and dem dey gada kom kwik-kwik.
27 No one taya or stagga for road
and dem nor stop to rest or sleep for road.
Dia belt nor kut and dia sandal rope nor ever luz.
28 Dem sharp dia arrow well and dia bows don ready to shot.
Dia horse dey make nois like stone wey dem nak togeda
and dia shariot taya dey turn like strong breeze.
29 Di sojas dey shaut like lion wey kill animal
kon karry am go where nobody go for fit take am from am.
30 Wen dat day rish, di sojas wey dey kom from far, go make loud nois give Israel pipol;
di nois go sound like wave for sea wey nak rock.
Den wen yu look di land, yu go si sey e skata and dey dark,
bikos di kloud don turn dia lite to darkness.