6
God Koll Isaya To Bi Profet
For di year wen King Uzzaya die, I kon si vishon as God sidan for en throne wey get glory for heaven and en klot kover di temple. Di kind creatures wey stand near am, dey bring out fire from dia mout and each of dem get six-six feada. Dem kover dia face with two feada; use two kover dia leg, den dem dey use di oda two take dey fly. Each of dem dey sing dey sey,
“holy, holy, holy! Na God wey get pawa,
dey holy and en glory full di world.”
Dia vois dey make di temple foundashon shake and smoke
kon full di whole temple.
I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
Den one of di creature fly kom meet mi for groun and e use big sizos take hold shako wey dey burn and na from di altar e for karry am kom. E use di hot shako take tosh my lips kon sey, “Dis tin don tosh yor lip, so from naw, yu don dey klean, bikos God don forgive yu.”
Den I hear God ask, “Who I go send? Who go bi awa messenja?”
So, I kon ansa, “I go-go! Make Yu send mi!”
So E tell mi make I go give di pipol dis message:
“E nor get as una go listin rish, una nor go undastand.
E nor get as una go look rish, una nor go know wetin dey happen.”
10 Den E tell mi,
“Go make dis pipol get strong heart,
deaf dia ear and blind dia eyes,
so dat dem nor go si, hear or undastand again.
If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi
and I go heal dem.”
11 I kon ask, “Oga God, how long dis tins go take happen?”
E ansa,
“Na till di town skata finish
and nor-tin go dey inside again.
Till nobody dey stay di house
and na until di land don turn where dem dey trow dirty put.
12 I go send my pipol go far place
and nobody go stay for di land again.
13 Even if na one pesin for evry ten pipol remain for di land,
dem go distroy am, e go bi like oak tree or Asherah pole
wey dem kut for groun or sometin wey dey holy wey dem distroy.
Dis holy tin,
na di special family wey God choose.”