50
God Help En Savant
Dis na wetin God tok:
“Una tink sey I drive my pipol komot
like man wey drive en wife komot en house?
Where di leta wey I take drive una mama?
Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren?
No! Una bi slave, bikos of una sins
and dem karry una komot from una land,
bikos of di bad-bad tins wey una do.
Why my pipol nor ansa wen I go meet dem
sey I go save dem?
Why dem nor ansa wen I koll dem?
I nor get pawa rish to save dem?
But I fit kommand di sea make e dry
kon turn river to desert, so dat di fish dem go die.
I fit kover di sky with darkness
kon make am wear sak like who dey mourn.”
God Savant Wey Dey Obey
God wey get pawa don tish mi wetin I go tok,
so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong.
Evry morning, I dey-dey happy to hear
wetin God dey tish mi.
God don make mi undastand well-well
and I neva tok anyhow or turn from am.
I dey open my back to pipol wey dey beat mi.
I nor dey stop dem wen dem dey curse mi;
even wen dem dey pul di hair wey dey my face komot.
But dia curse nor dey pain mi
and bikos God wey get pawa dey help mi,
I dey fit bear dem.
I know sey dem nor go fit disgrace mi,
bikos God dey near and E go show sey,
I dey innocent.
So, e get anybody wey go fit komplain about mi?
Den, make wi go kourt togeda!
Make e kom tok wetin I do!
Na God wey get pawa, help mi,
so who go fit sey I dey guilty?
All di pipol wey dey akuiz mi go disappear,
dem go vanish like klot wey dey fade.
10 All of una wey dey respet God
and obey en savant words,
di road wey una dey waka fit dey dark,
but make una trust una Oga God!
Make una put hope for una God.
11 All of una wey dey plan to distroy oda pipol,
na una own plan go distroy una.
God ensef go make dis tins happen
and una go sofa well-well.