51
Dem Konfort Jerusalem
God sey, “Una wey wont make dem save una;
una wey dey kom meet mi make I help una.
Make una tink of di Rock wey una from kom,
di place where dem from kut una from.
Make una tink of Abraham,
una grand-grand papa and Sarah wey born una.
Wen I koll Abraham, e nor get pikin,
but I bless and gi-am shidren
kon make en shidren-shidren, plenty.
I go sorry for Jerusalem
and evribody wey dey stay di land wey dem skata.
Even doh en land na desert, I go turn am to gardin
and e go bi like Eden gardin.
Joy and happiness go dey der
and dem go sing songs take praiz and tank mi.
My pipol, make una listin to mi!
Make una listin to wetin I dey tok:
I dey tish di nashons and my laws go bring lite to dem.
I go kom save dem kwik-kwik,
bikos my time to win, don near.
Mi mysef go rule all di nashons.
Di lands wey dey far dey wait make I kom;
dem dey wait with hope make I kon save dem.
So make una look heaven and eart!
Di heavens go vanish like smoke,
di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly.
But wen I diliver am, e go last forever.
My viktory, na di final one.
Pipol wey know wetin dey rite,
wey put wetin I dey tish dem for dia heart,
make dem listin to mi.
Make dem nor fear wen pipol dey curse dem.
Dem go vanish like klot wey ant chop!
But wen I diliver una, e go last forever;
my viktory go last forever.”
Oga God, make Yu raiz-up kon help us!
Save us with yor pawa.
Make Yu use yor pawa,
just as Yu dey do before.
Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea,
na Yu kut am to pieces.
10 Na Yu dry di sea kon make road for inside wota,
so dat di pipol wey Yu won save,
go fit waka pass for dry groun.
11 Doz wey Yu don save go rish Jerusalem with joy,
dem go dey sing and shaut with happiness.
Dem go dey happy
and dey free from sorrow forever.
12 God sey, “Na mi dey give una pawa.
So why una dey fear ordinary men
wey nor go last pass grass?
13 Una don forget God wey make una;
di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon?
Why una dey always fear pipol wey dey opress una;
doz wey ready to distroy una?
But naw, una nor go fear dem again.
14 Dem go soon free pipol wey dey for prison;
dem go get long life and honga nor go kill dem.
15 Na mi bi di Oga wey bi una God,
I dey shake di sea kon make di wave shaut.
My name na God wey get pawa!
16 I stresh heaven kon make di eart foundashon!
I tell Jerusalem,
‘Una bi my pipol!
I don tish and protet una with my hand.’ ”
Jerusalem Sofa Don End
17 Jerusalem, make una wake-up!
Make una karry unasef up!
Una don drink from di ponishment cup wey God give una,
bikos E dey vex.
Una drink am and e dey make una stagga.
18 Nobody dey wey go lead una;
nobody among una pipol go hold una for hand.
19 Wahala don fall for una head;
war don skata una land and una pipol dey hongry.
E nor get anybody wey go sorry for una.
20 Una shidren dey fall and faint street,
bikos dem don weak;
dem bi like animal wey hunta net katch.
Dem don si how God vexnashon dey bi.
21 Jerusalem pipol wey dey sofa,
una wey dey stagga like sey una don drink,
22 di Oga wey bi una God dey defend una naw sey,
“I dey take di cup wey I give una with vexnashon.
Una nor go drink di wine wey
dey make una stagga again.
23 But I go gi-am to pipol wey dey opress una;
doz wey dey make una liedan for street
kon waka on-top una like sey una bi dirty.”