52
God Go Save Jerusalem
Jerusalem pipol, make una dey great and strong again!
God holy town, make una wear pride like klot!
Pipol wey nor know God nor go enter una gate again.
Jerusalem pipol, make una shake unasef
kon dey free!
Make una stand up from dirty kon sidan for una throne!
Zion pipol, make una luz di shain wey tie una!
God wey get pawa dey tell en pipol sey,
“Wen una bi slave,
dem nor pay any money take buy una,
na so too, dem nor go pay anytin to take free una.
Wen una go stay for Egypt as strenja,
na una own mind una take do am;
even doh, Assyria pipol use force karry una komot,
dem nor still pay anytin for una head.
Di same tin don happen naw for Babilon,
una don bi slave and dem nor pay anytin for una head.
Pipol wey dey rule una dey make mout
and dem dey always use my name make yeye.
But di time dey kom wen una go know
sey na mi bi God and I don tell una.”
Si as e dey good to si messenja
wey dey kom give una peace and good news from di mountins!
E dey announce sey una don win
kon tell Zion pipol sey, “Una God na king!”
Pipol wey dey guide di town,
dey shaut as dem dey happy,
bikos dem don si sey God dey kom back to Zion.
Jerusalem wey dem skata,
make una shaut dey happy,
bikos God go save en pipol
kon give dem peace.
10 God go use en holy pawa take save en pipol
and di whole world go si am.
11 All of una wey dey karry di temple tins,
make una know sey God go save una from Babilon.
So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid;
make una make unasef holy,
so dat una nor go die.
12 Una nor go hurry komot dis time,
or try to eskape,
bikos di Oga wey bi una God,
go lead and protet una for evry side.
Savant Wey Dey Sofa
13 God sey, “My savant go get wetin e dey find;
dem go honor am well-well.
14 Pipol go sopraiz wen dem si am,
bikos dem bin beat am well-well
and e nor bi like human being again.
15 But naw, many nashons go happy for am
and kings nor go fit tok anytin.
Dem go si and undastand di tins
wey dem neva hear before.”