59
Di Profet And Di Pipol
Make una nor tink sey God dey too weak to save una
or dey deaf to hear wen una koll am for help!
Na bikos of una sins make am nor dey hear una.
Na una sins dey separate una from God wen una try to woship am.
All una words na lie and pipol wey una kill,
dia blood don stain una hand.
Una dey go kourt and dey lie for each oda head.
Una dey put hope for lie, so dat una go win una kase.
Una dey make plans to take hurt oda pipol.
Di evil wey una dey do dey bad like di poizin
wey dey snake wey dem just born.
But di evil nor go do una any good;
dem dey yuzles like klot wey dem make with dirty!
Na only evil tins una dey plan to do.
Una nor dey fear to kill innocent pipol.
Anywhere wey una dey go,
na only wahala una dey kause for der
and nobody dey save around una.
Evritin wey una dey do nor get betta judgement.
Una dey follow di wrong road.
And nobody wey dey pass dat road, dey save.
Di Pipol Konfess
Di pipol sey, “Na naw wi know why God nor save us
from doz wey dey opress us.
Wi dey hope sey wi go si lite,
but na only darkness wi dey si
10 and wi dey waka anyhow
like blind pipol.
Wi dey fall for aftanoon and for nite;
e bi like sey wi dey dark world,
for where dead pipol dey.
11 Dem dey sofa and make us fear.
Wi won si God, so dat E go save us from di opreshon
and bad tins wey wi dey do,
but e nor gri work.
12 Oga God, di bad tins wey wi do against Yu,
plenty well-well.
Awa sins dey fight us
and wi know sey na so e bi.
13 Wi don fight, rijet and refuse to follow Yu.
Wi opress odas kon turn from Yu.
All wetin wi dey tok and tink, na lie dem bi.
14 Betta judgement dey far from us
and good tins nor fit kom near us.
Trut nor dey for where pipol gada
and nobody dey good.
15 Trut nor dey awa mout again
and di pesin wey nor dey won do evil,
dem dey take en tins from am.
God dey look and vex,
bikos betta judgement nor dey una body.”
God One Save En Pipol
16 E dey sopraiz am sey,
nobody dey to help pipol wey dem dey opress.
So E go save dem with en own pawa
kon make dem get viktory.
17 E go wear good judgement for body like war koat
kon wear viktory like priest kap for en head.
E go wear klot wey go make am do good tins
kon ponish doz wey dey sofa pipol.
18 E go ponish en enemies akordin to wetin dem do;
even doh dem dey stay for far place.
19 From east go rish west,
evribody go fear en and en great pawa.
E go kom like river wey dey rush well-well
and like strong breeze wey dey blow.
20 God dey tell en pipol sey, “I go kom Jerusalem
kon defend and save all of una wey turn from una sin kom meet mi.
21 I make kovenant with una sey:
I don give una my pawa and word forever and from naw go,
make una dey obey mi
kon tish una shidren and shidren-shidren,
so dat dem go obey mi forever.”