60
Jerusalem Glory
Jerusalem pipol, make una raiz and shine like sun,
bikos God glory dey shine on-top una!
Even wen darkness kover evry oda nashon,
God lite go shine on una own and en present wey brite well-well,
go dey with una.
Nashons go kom enter una lite
and kings go enter una brite lite.
Make una look round kon si wetin dey happen;
una pipol dey gada kom house!
Una shidren go kom from far place;
dem go karry una girls for shoulder kom back.
Una go si dis tins kon happy;
una go dey happy as una dey waka.
Dem go bring all di nashons propaty kom give una.
Dem go bring dia money from di oda side of di river kom.
Plenty karavan with kamels go kom una land
from Midian and Efah town.
Dem go kom give una gold and incense from Sheba town.
Pipol go tok about di good tins wey God don do for una!
Dem go bring all Kedar and Nebaiot sheep
kon give una as sakrifice
and dem go offa dem for di altar
to take make belle sweet God.
God temple go get glory pass as e get before.
So, wetin bi all dis sheep wey dey pass like kloud;
like doves wey dey go house?
Di ship dem dey kom from far;
dem dey karry God pipol with silva and gold kom back to dia house
and to take honor God name,
di Oga wey bi Israel pipol God wey dey holy
and all di nashon dey honor en pipol.
10 God tell Jerusalem pipol,
“Oda pipol go build una wall and dia kings go serve una.
I bin ponish una, bikos I dey vex,
but naw, I go show una my favor and mesi.
11 Una gates go dey open both for day and nite,
so dat kings go bring dia propaty kon give una.
12 But dem go distroy any nashon
wey nor gri serve una.
13 Dem go bring pine wood, junipa, cypress
and di wood wey fine pass for Lebanon forest
kom take build Jerusalem again;
so dat my temple go fine and di town go get glory.
14 Doz wey bin dey opress una,
dia sons go kom bow for una.
All di pipol wey look down on una before,
go kon woship una.
Dem go koll una, ‘Oga God Town.
Zion, di town wey Israel God wey dey holy dey stay.’
15 Dem nor go hate and look down on una again.
Una town wey dem skata and distroy,
I go make am great and beautiful
and joy go dey der forever and ever.
16 Nashons and kings go kare for una
as mama dey kare for en pikin.
Den, una go know sey,
mi wey bi God, don save una.
Israel God wey get pawa don free una.
17 Instead of bronze,
I go give una gold.
I go give una silva and bronze,
instead of iron and wood;
den I go still give una iron,
instead of stone.
Una rulers nor go opress una again and I go make dem rule
with betta judgement and peace.
18 Dem nor go hear wahala sound again for dis town;
distroshon nor go skata una kountry again.
I go protet and defend una like wall;
den una go praiz mi, bikos I don save una.
19 Di sun nor go bi una lite for day time again
or di moon for nite,
bikos na mi, wey bi God,
go bi una lite forever and my glory lite
go always dey shine on una.
20 Una days of pains don end.
Mi wey bi God go bi una lite forever
and e go last pass di sun and moon.
21 Una pipol go do di rite tin
and dem go get di land forever.
Na mi plant and make una,
so dat evribody go know how I great rish.
22 Even una small family wey dey honbol demsef,
go dey great like nashon wey get pawa well-well.
Wen di time rish, I go make dis tins happen kwik-kwik.
Na mi wey bi God, tok am!”