61
Good News
God wey dey mighty, en Spirit dey on mi,
bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol;
heal doz wey dia heart break;
announce make dem release doz wey bi slave
and free doz wey dey for prison.
E send mi kom tell pipol sey
di time for God to save en pipol and defeat dia enemies, don rish!
Yes, E go konfort doz wey dey mourn.
E sey, instead of sadnes,
E go give joy and happiness to doz wey dey mourn for Zion.
Instead of sorrow,
E go put praiz song for dia mout.
Dem go bi like tree wey God plant by ensef.
All of dem go do wetin dey rite
and dem go praiz God for wetin E don do.
Dem go ribuild di towns wey skata
kon ripair di place dem wey pipol distroy.
My pipol, strenjas go serve una.
Dem go kare for una animals;
farm for una land and kare for una vineyards.
Dem go know una as God priests wey bi en savant.
Una go enjoy di nashon propaty.
Den una go dey proud sey na una own.
Una shame and disgrace don end.
Una go stay for una own land and una propaty go bi times two,
den una joy go last forever.
God sey, “I like betta judgement,
but I hate opreshon and wahala.
I go dey faithful to reward my pipol
and make kovenant wey go last with dem.
Dem go know dem for all di nashons and anybody wey si dem,
go know sey dis na pipol wey I bless.”
10 Jerusalem pipol dey happy,
bikos of wetin God don do.
E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage.
God don wear salvashon and viktory klot for en body.
11 Just as seed dey take grow,
na so God wey bi king,
go take save en pipol and all di nashons go praiz am.