3
Di Remainin Nashons
Dis na di nashons wey God leave for di land to take test Israel pipol wey neva fight war with Kanaan pipol before. E leave doz nashon for der, bikos E won use dem take tish di yong pipol for Israel wey neva fight war before. Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat. God leave dis pipol to take test Israel pipol, weda dem go obey di kommand wey E give dem thru Moses, dia grand-grand papa.
So Israel pipol kon dey stay among Kanaan, Hit, Amor, Perez, Hiv and Jebus pipol and dem marry demsef too. Israel sons marry Kanaan girls; while Israel girls marry Kanaan sons and Israel pipol kon dey serve Kanaan gods.
Otniel
Israel pipol forget di Oga dia God; dem sin against am kon bigin serve Baal and Asherah juju. So God vex well-well kon send dem go serve King Kushan-Rishataim for Aram Naharaim for eight years. Wen Israel pipol kry give God make E help dem, God kon send one man among dem wey save dem. En name na Otniel wey en papa na Kenaz wey bi Kaleb yonga broda. 10 God Spirit enter am, so e kon bi leader for Israel. E go war go fight against King Kushan-Rishataim and God kon help Otniel, win am. 11 So peace kon dey di land for forty years. Den Otniel wey bi Kenaz pikin kon die.
Ehud
12 Israel pipol sin against God again, so God kon give dem to King Eglon for Moab. 13 King Eglon join Ammon and Amalek pipol kon fight and win Israel pipol, den dem take Jeriko town wey palm tree full. 14 Israel pipol serve King Eglon for Moab, for eighteen years.
15 But wen Israel pipol kry give God for help, God kon still send one man go save dem. En name na Ehud, Gera pikin. Na left hand e dey use pass and e kom from Benjamin tribe. Israel pipol send Ehud go meet King Eglon for Moab with many gift. 16 Ehud make swod wey get two mout and e long small. E hide am for di rite side under en klot. 17 Den e take gift go give King Eglon wey fat well-well. 18 Wen Ehud don gi-am di gift, en and di men wey bring di gift kon dey go house back. 19 But Ehud go back go meet King Eglon and wen e rish di Idol Stone near Gilgal, e kon tell am, “My oga, I get one sekret message for yu.”
So di king kommand en savants, “Make una kwayet!” Den e sey make dem komot from di room.
20 So Ehud waka go meet Eglon for where e sidan alone for one kool room for upstair, den e sey, “I get one message from God for yu!” As King Eglon get up from en chair, 21 Ehud use en left hand bring out di swod for where e hide am put kon shuk di king for belle. 22 Di swod enter di King belle well-well sotey e kover di swod head. So Ehud nor fit pul di swod komot from en belle and all di king intestine kon kom out. 23 Den Ehud go outside, klose and lock di door, den e kon pass di toilet run go.
24 Afta Ehud don go, di king savant kon si sey di room door dey lock. Dem tink sey di king dey di toilet for di palor, 25 so dem kon dey wait, but afta sometaim wen e nor kom out, dem take di key open di door kon si dia masta don die for groun.
26 Ehud run pass di Idol Stone go Seirah, as di oda savants still dey wait. 27 Wen e rish di hill kountry for Efraim, e blow trumpet kon koll Israel men for war; den e lead dem kom down from di hill.
28 E tell dem, “Make una follow mi, bikos God don give una viktory ova una enemies, (Moab pipol).” So dem follow am kon seize di place wey Moab pipol dey pass cross go Jordan River and dem nor allow anybody cross. 29 Dat day, dem kill about 10,000 men wey strong well-well for Moab and no one among dem fit eskape. 30 So Israel pipol win Moab pipol dat day and peace kon dey di land for eight years.
Shamgar Judge Israel Pipol
31 Afta Ehud, di next leader wey Israel get na, Shamgar, Anat pikin and en too save Israel pipol wen e use animal bone take kill 600 Filistia pipol.