4
Deborah And Barak
Afta Ehud die, Israel pipol sin against God again. So God kon give dem to King Jabin for Hazor for Kanaan make e rule dem. Di kommander for en sojas na Sisera, wey kom from Haroshet-Haggoyim. Sisera, get 900 iron war horse and e opress and rule Israel pipol with wikedness for twenty years, before Israel pipol kon kry give God make E help dem.
Dat time, Deborah wey bi Lappidot wife, na profetes and judge for Israel. E dey always sidan under one palm tree wey dey between Rama and Bethel for Efraim hill kountry and Israel pipol dey go der go meet am, make e judge dem. One day, e send message go koll Barak, Abinoam pikin, wey dey stay for Kedesh for Naftali land kon tell am, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God kommand sey make yu do: Make yu koll 10,000 wariors from Naftali and Zebulun tribe go Mount Tabor. And I go bring Sisera, kommander for Jabin sojas, with en war horse and warrior kom Kishon River and for der, I go give una viktory ova am.”
But Barak ansa, “If yu nor follow mi go, I nor go-go anywhere.”
Den Deborah sey, “Okay! I go follow yu go, but nobody go praiz yu for dis war, bikos God don sey na woman go kill Sisera.” So Deborah kon follow Barak go Kedesh. 10 Barak koll Zebulun and Naftali tribe kon gada dem togeda for Kedesh and na 10,000 wariors follow am. Deborah still follow am go too.
11 By dis time, Heba, one Kenite man, komot from where en oda tribe pipol dey, go build en tent for near Kedesh, near one oak tree for Zaanannim. Na Moses broda-in-law wey Hobab bi en grand-grand papa.
12 Wen dem tell Sisera sey, Barak, Abinoam pikin don go Mount Tabor, 13 e koll en 900 iron war horse and en men, den dem mash komot from Haroshet-Haggoyim go Kishon River.
14 Deborah tell Barak, “Make yu ready, bikos God dey lead yu and today E go give yu viktory ova Sisera.” So Barak kom down from Mount Tabor with en 10,000 men. 15 Wen Barak attack, God kon konfuse Sisera and en men. Sisera kom down from en war horse kon take leg dey run. 16 But Barak porshu di war horse and Sisera men go Haroshet-Haggoyim kon kill all of dem for der.
17 By dat time, Sisera run go meet Jael wey bi Herber from Kenite, wife. Bikos King Jabin for Hazor and Herber family na friends.
18 Jael go outside go meet Sisera kon tell am, “My oga! Make yu kom inside my house. Make yu nor fear at-all.” So Sisera go inside, den di woman hide am kon take blanket kover am.
19 Sisera tell am, “Abeg, make yu give mi wota drink, bikos my trot don dry.” So di woman gi-am milk from one leda bag, den kon kover am again.
20 Den Sisera tell di woman, “Make yu stand for di door and if anybody kom ask yu weda pesin dey here, make yu sey no.”
21 But as Sisera dey sleep, bikos e don taya well-well, Jael kon take hammer and nail waka small-small go near am kon nail en head from di korna join groun, so Sisera kon die.
22 Wen Barak find Sisera rish der, Jael tell am, “Make yu kom si di man wey yu dey find.” So Barak follow di woman enter di tent and e kon si sey Sisera don die, bikos di woman nail en head join groun.
23 So for dat day, God kon give Israel pipol viktory ova Jabin wey bi Kanaan pipol king. 24 From dat time go, Israel pipol kon get pawa and strong more-more pass King Jabin, until dem distroy am finish.