2
Love Evribody
My brodas and sistas, since una get faith for awa Oga God Jesus Christ, make una nor dey do parsha. If pesin wear gold ring and fine klot enter una church and poor pesin with dirty klot enter too and una respet di one wey wear fine klot, kon tell am, “Sidan for betta place,” but una tell di poor pesin, “Stand der,” or “Sidan for groun.” Dat mean sey una dey do parsha and kondemn pipol from una mind. My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am? But una nor dey respet poor pipol! Nor bi rish pipol dey opress and drag una go kourt? Or dem nor dey tok bad about Jesus name wey una bilive? But if una do wetin dem rite for God word, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef,” una don do good bi dat. If una do parsha, una dey kommit sin and di law don kondemn una as pipol wey nor dey do wetin dey di law. 10 Di pesin wey dey do evritin wey dey di law and e break one, don break all of dem bi dat. 11 Bikos di same God wey sey, “Nor sleep with who yu nor marry,” naim still sey, “Nor kill anybody.” If yu nor sleep with who yu nor marry, but yu kill pesin, yu don break di law bi dat. 12 Make una tok and do like pipol wey dem go judge with di law wey go free pipol. 13 Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.
Faith And Work
14 My brodas and sistas, wetin dey good if pesin sey e get faith, but e nor dey do anytin? Dat kind faith go fit save am? 15 If one broda or sista nor get klot to wear or food to chop 16 and one pesin among una tell am, “Make peace dey with yu; make kold nor katch yu and make yu go chop beleful, but yu nor gi-am wetin di body wont, na wish kind good bi dat?” 17 Na so faith bi too, if yor faith nor dey produce betta result, e go die and dey yuzles. 18 If anybody sey, “I get faith and yu get work.” I go sey, “Make yu show mi yor faith wey nor get work and I go show yu my faith thru my work.” 19 Yu bilive sey na only one good God dey. Demons bilive so too and fear dey katch dem well-well.
20 Foolish man! Yu wont make I show yu sey faith wey nor get work dey yuzles? 21 Wen awa papa Abraham put en pikin Isaak for di altar, wetin e do dey good for God eye? 22 Yu nor si sey en faith and work dey togeda and na en work make en faith pafet? 23 And wetin dem rite for God word kon happen, “Abraham bilive wetin God tok and na dat one make am good for God eye, so God kon koll am, en friend.” 24 So, pesin work dey make am good too, nor bi only en faith. 25 Nor bi so e bi for Rahab, wey bi ashawo, wen e welkom di messenjas kon show dem anoda road wey dem go pass run? 26 Body wey nor get spirit don die, na so too, faith wey nor get work, don die.