3
Di Pawa Wey Dey Awa Tongue
My brodas and sistas, evribody nor go fit bi tisha, bikos yu know sey wi wey dey tish, na awa judgement go big pass, bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body. If wi tie rope for horse mout make e for obey us, dat mean sey wi dey kontrol en body. Look ship for wota: E big well-well and na strong breeze dey fit push am, but na one small wheel di driver dey use take kontrol am. Na so di tongue bi too: naim small pass for di body, but di tins wey e fit do big well-well. Make una tink how small fire fit burn big forest rish groun. Di tongue na fire! Na der bad tins full pass for pesin body. E dey spoil di whole body and kause fire for pesin life and dis kind fire dey kom from hell.
Human being dey fit kontrol bird, animal wey dey creep for groun and animal wey dey stay for wota. But nobody don ever fit kontrol en tongue well. Di tongue na bad tin wey nor dey stay one place, bikos e get poizin wey fit kill pesin. Na di tongue wi take dey praiz awa Papa and Oga God Jesus Christ and naim wi still dey use take curse pipol wey God kreate like ensef. 10 My brodas and sistas, na di same tongue wi dey use take praiz and curse pipol. But e nor suppose bi like dat. 11 Wota wey dey kom out from groun, nor dey bring out fresh and bitter wota from di same place, abi e dey do so? 12 My brodas and sistas, fig tree go fit bear olive, abi vine fit bear fig? So too, wota wey dey kom out from groun and e taste like salt, nor go fit taste like fresh wota at-all.
Betta Wisdom
13 Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring. 14 But if jealousy and sefishnes dey en mind, make e nor boast and lie against di trut. 15 Dat kind wisdom nor kom from God, but e kom from dis eart wey wiked well-well. 16 Bikos where jealousy and long-trot dey, wahala and bad tins wey pipol dey do, dey der too. 17 But God wisdom dey pure; e get peace; dey gentol; dey asept pipol and good fruit and mesi full am; e nor dey do wayo or pritend. 18 Pipol wey nor like trobol, dey plant fruit wey dey bring raitiousness.