10
Di Good Shepad
“Na true word I dey tell una, pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep, but klimb pass anoda side enter di place, na big tif. Di pesin wey pass di door enter, na-im bi di shepad wey dey guide di sheep. Di gateman go open di door for am and en sheep go hear en vois wen e koll dia name and e go lead dem kom out. Wen e don bring all en sheep kom out, e go-go dia front and di sheep go follow am, bikos dem know en vois. Dem nor go gri follow strenja, but dem go run from dem, bikos dem nor know di strenja vois.” Jesus tell dem dis parabol, but dem nor undastand wetin e tok.
So Jesus kon tell dem again, “I dey tell una true word. Na mi bi di door wey di sheep go must pass enter. All di pipol wey kom before mi, na big tif dem bi and di sheep nor go gri listin to dem. Na mi bi di door, anybody wey enter thru mi, God go save am. E go-go inside and out and e go si betta grass chop. 10 Di tin wey tif dey do, na to tif, kill and distroy pipol, but mi, I kom so dat pipol go get life, di kind life wey full well-well.
11 “Na mi bi di good shepad. Di good shepad ready to die for di sheep. 12 Di pesin wey dem hire nor bi di shepad and bikos nor bi en get di sheep, e go run wen e si lion dey kom, so di lion go skata di sheep, kon kill di ones wey e katch. 13 Bikos di pesin nor kare for di sheep, go run leave dem.
14 “Na mi bi di good shepad, I know di sheep wey bi my own and dem know mi too. 15 Bikos my Papa know mi and I know am, naim make mi ready to die for di sheep. 16 I get oda sheep wey nor dey here. I must gada dem too and dem go listin to my vois, all of dem go dey togeda and na one shepad go lead dem. 17 Na dis bi di rizin wey make my Papa like mi, bikos I ready to sakrifice my life, so dat I go fit get di life back again. 18 Nobody go fit take my life from mi, but na mi go put am down by mysef and I get di pawa to take am back again. Dis na wetin God kommand mi to do.”
19 Anoda big kworel kon happen between di Jew pipol bikos of wetin Jesus tok. 20 Many of dem kon dey sey, “Demon dey inside am and en head nor korrect. Why una dey listin to am sef?”
21 Odas kon sey, “Di pesin wey get demon nor go fit tok like dis. No demon fit make blind pesin si.”
Jesus Go Di Dedikashon Feast
22 Di time for di Dedikashon Feast for Jerusalem kon rish. 23 Dat na di time wey rain dey fall (and kold dey strong well-well) and Jesus kon dey waka inside di varanda where Solomon for dey take breeze, wey dey inside di temple yard. 24 Di Jew oga dem gada round Jesus, kon ask am, “How long yu go make us dey wait? If na yu bi di Christ, make yu tell us.”
25 Jesus ansa dem, “I don tell una and una nor bilive. Di tin wey I take my Papa name dey do, dey bear witness for mi. 26 But una nor bilive mi bikos una nor bi my sheep. 27 My sheep dey hear my vois and I know dem and dem dey follow mi. 28 I don give dem life wey nor dey end and dem nor go ever die. Nobody go fit take dem komot from my hand. 29 My Papa wey give dem to mi big pass evribody and nobody go fit take dem komot from my Papa hand, 30 bikos mi and my Papa, na one.”
31 Di Jew oga dem kon pick stone again, won kon stone am. 32 So Jesus tell dem, “I don do many good tins wey una si from my Papa, wish one make una won stone mi so?”
33 Di Jew oga dem ansa, “Wi nor won stone yu bikos of di good tins, but na bikos yu wey bi ordinary pesin, dey make mout sey, yu bi God.”
34 Jesus ask dem, “Una law nor tok sey, I sey, ‘Una bi gods?’ 35 If dem koll di pipol wey God send en word go meet, sey, ‘Dem bi gods’ and God word nor go ever shange, 36 Why una dey tell di pesin wey God choose for ensef and wey E send kom dis world sey, Yu dey tok against God, bikos I sey, ‘I bi God Pikin?’ 37 If I nor do di tins wey my Papa send mi, make una nor bilive mi. 38 But if I dey do dem, even if una nor bilive mi, make una bilive di tins wey I dey do, so dat una go know and undastand sey, I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi too.” 39 So dem try again to katch am, but e kon waka leave dem.
40 Jesus go back kon cross Jordan River, where John for baptize pipol and e kon stay for der. 41 Many pipol kom meet Jesus for di place. Dem bigin dey sey, “Even doh John nor do any mirakle, but evritin wey e tok about Jesus, na true.” 42 And many pipol for di place kon bilive Jesus.