9
Jesus Heal Blind Man
Wen Jesus dey waka pass, e kon si one man wey blind from di time wey en mama born am. En disciples ask am, “Tisha, na wish pesin sin, wey make dis man blind since di time en mama born am? Na di man or na en papa and mama?”
Jesus ansa dem, “Nor bi di man or en papa and mama sin, but e blind since dem born am, bikos God won use dis one show en pawa with wetin go happen to am. I must do di work for di Pesin wey send mi before day go dark, bikos nite dey kom wen nobody go fit work. As far as I dey inside dis world, na mi bi di lite for di world.
“Afta e tok finish, e spit for groun kon take di san-san wey e spit put take rub di blind man eye. Den e tell am, Make yu go wosh yor face inside di pond wey dem dey koll Siloam (dis name mean ‘Send’).” So di blind man kon go wosh en face as Jesus tell am. As e dey kom back, e kon bigin si.
Den en neighbours and oda pipol wey dey si am dey beg before, kon ask sey, “Dis nor bi di man wey dey sidan dey beg for money?” Some pipol ansa, “Na-im o-o!” Odas tok sey, “Nor bi en, but e look like am.”
Di man ensef kon sey, “Na mi bi di pesin.”
10 Dem ask am, “Wetin happen wey make yu bigin si?”
11 E ansa dem, “Na di man wey dem dey koll Jesus take san-san wey e spit put rub my eye. Den e tell mi sey, ‘Make yu go Siloam go wosh yor face.’ Afta I go wosh my face for di pond, I kon bigin si.”
12 Naim dem ask am, “Where di man dey?”
E ansa dem, “I nor know o-o.”
Di Farisee Pipol Kweshon Di Man
13 Dem take di man wey blind before go meet di Farisee pipol, 14 (bikos na for Sabat Day Jesus spit for san-san take rub di blind man eye). 15 Naim di Farisee pipol ask am again, “How yu take bigin si?” E ansa dem, “E take di san-san wey e spit put rub my eye and afta I don wosh my face, I kon bigin si.”
16 Some Farisee pipol kon sey, “Nor bi God send dis man, bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.”
But odas sey, “How pesin wey dey kommit sin go fit do dis kind mirakle?” Dis argument kon make di pipol divide.
17 Dem ask di man wey blind before sey, “Wetin yu tink about di man wey make yu dey si?”
Di man ansa, “Na profet e bi.”
18 Di Jew oga dem nor gri bilive sey, true-true di man blind before, so dem kon koll en papa and mama. 19 Dem ask dem, “Na una pikin bi dis? Na true sey e blind wen una born am? How e kon take dey si naw?”
20 So en papa and mama ansa, “Wi know sey dis na awa pikin and e blind wen wi born am. 21 But wi nor know how e take bigin si or even who open en eye. Make una ask am, e don big rish to tok for ensef.” 22 (En papa and mama tok like dis, bikos dem dey fear di Jew oga dem wey don tok sey, “Anybody wey tok sey na Jesus bi di Christ, dem go drive am komot from di sinagog.” 23 Na dis one make en papa and mama sey, “Make dem ask am, bikos e don big rish to tok for ensef).”
24 So dem koll di man again kon tell am, “Make yu promise before God sey yu go tok di trut, bikos wi know sey di man na sina.”
25 Man ansa dem, “Weda na sina e bi, I nor know! But wetin I know bi sey, before I blind, but naw, I don dey si.”
26 So dem ask am again, “Wetin e do? How e take make yu dey si sef?”
27 E kon ansa dem, “I don tell una before, but una nor gri. Why una won hear am again? Abi, una won bi en disciples too?”
28 Dem shaut for di man kon sey, “Na yu bi en disciple. Wi bi Moses disciples. 29 Wi know sey God tok to Moses, but wi nor know where dis man from kom.”
30 Di man kon sey, “I sopraiz for una o-o. Una nor know where e from kom, but na-im open my eye! 31 Wi know sey God nor dey listin to anybody wey dey sin, but if pesin dey do wetin God tok, God go hear en prayer. 32 Wi neva hear before sey, anybody don fit make pesin wey blind si. 33 If God nor send dis man, e nor go fit do dis kind tin.”
34 Dem kon tell di man, “Na for inside sins born yu, yu tink sey yu go fit tish us anytin?” So dem drive am komot from di place.
Di Man Follow Jesus
35 Wen Jesus hear sey dem don drive di man komot, e go look for am kon ask am, “Yu bilive who Man Pikin bi?”
36 Di man kon sey, “Oga God, tell mi who e bi, make I for fit bilive am?”
37 Jesus ansa am, “Na-im dey here dey tok to yu so.”
38 Di man kon sey, “Oga God, I bilive.” Den e knee down kon woship Jesus.
39 Jesus tell am, “I kon judge pipol for di world, so dat di pipol wey nor dey si, go bigin si and doz wey tink sey dem dey si, dia eye go blind.”
40 Wen di Farisee pipol wey dey der hear wetin Jesus tok, dem kon ask am, “Yu tink sey wisef blind?”
41 Jesus ansa dem, “If una gri sey una blind, God nor go kondemn una bikos of una sin, but as una tok sey una dey si so, una sin dey for una head.”