16
Jesus Promise To Send Di Holy Spirit
“I dey tell una all dis tins, so dat nobody go fit deceive una. Dem go drive una komot for di sinagog and di time dey kom wen di pesin wey go kill una, go tink sey e dey do God work. Dem go do all dis tins, bikos dem nor know mi and my Papa. But I tell una all dis tins, so dat wen di time rish, una go remember sey I tell una about dem before. I just dey tell una all dis tins, bikos I dey with una since.
“Naw, I dey go meet di Pesin wey send mi kom, but una dey ask mi, ‘Where yu dey go?’ But una nor happy as I dey tell una all dis tins. I tell una true word, na for una own good naim make mi won go, bikos if I nor go, di Pesin wey go help una nor go kom, but if I go, I go send am kom meet una. Wen e kom, e go show pipol for dis world wetin sin, God raitiousness and God judgement, bi. Di Spirit go show dem sey dem dey wrong about sin, bikos dem nor bilive mi. 10 Dem dey wrong about God raitiousness, bikos I dey go meet my Papa and dem nor go si mi again. 11 And dem dey wrong about judgement, bikos God don kondemn di pesin wey dey rule dis world.
12 “I get plenty tins wey I won tell una, but una nor go fit bear dem naw. 13 But wen God Spirit kom, e go show una di trut. E nor go tok wetin dey en mind, but e go tok wetin e hear from God and wetin go happen afta I don go. 14 E go dey give mi glory wen e dey tell una di tins wey e dey hear from mi. 15 Evritin wey my Papa get, na my own, naim make mi tok sey di Spirit go tell una wetin e dey hear from mi.
16 “Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi.”
17 Den some among di disciple kon dey ask each oda, “Wetin e mean wen e sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi bikos I dey go meet my Papa?’ ”
18 Some still sey, “Wetin e get for mind wen e sey, ‘Time go soon kom?’ Wi nor undastand wetin e dey tok.”
19 Jesus si sey dem won ask am about wetin e tell dem, naim e ask dem, “Una dey ask each oda wetin I mean wen I sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi?’ 20 I tell una true word, una go kry and mourn, but di world go dey happy; una go dey sad well-well, but una sadnes go turn to happiness. 21 Wen woman won born pikin, e dey sofa strong pain, bikos en time to born don rish, but wen e don born, e go happy and e nor go remember di pain again, bikos e go si sey e don born pikin. 22 Na so e bi for una naw, bikos una heart dey heavy, but I go si una again and for dat time, una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una. 23 By dat time, una nor go ask mi anytin again. I tell una true word sey, anytin wey una ask my Papa with my name, E go give una. 24 Before naw, una neva take my name ask for anytin. Naw make una use my name ask for anytin wey una wont and una go get am, so dat una joy go full well-well.
25 “Since I dey use parabol tok to una; but di time dey kom wen I nor go use parabol again, but I go tell una about my Papa for di way wey una go undastand. 26 By dat time, una go fit ask anytin with my name and God go do am for una. 27 My Papa love una, bikos una love mi and bilive sey na-im send mi. 28 Na my Papa send mi kom dis world, but naw, I dey go back go meet am.”
29 En disciples kon sey, “Yu si, na naw yu dey tok for di way wey wi undastand and nor bi with parabol. 30 Naw wi know sey yu know evritin and yu nor nid anybody to ask yu any kweshon. Bikos of dis, wi bilive sey na God send yu kom.”
31 Jesus kon tell dem, “So una don bilive naw? 32 Look, di time dey kom and e don even rish, wen una go skata and evribody go-go en own way and I go stay alone. But I nor dey alone, bikos my Papa dey with mi.
33 “I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”