17
Jesus Pray Make God Honor Am
Wen Jesus don tok all dis tins finish, e look heaven kon sey,
“My Papa, di time don kom wen yu go give glory to yor pikin, so dat yor pikin go give yu glory too. Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi. Life wey nor dey end, dis na wetin e mean, ‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ, wey yu send.’ I don give yu glory for dis world and I don finish di work wey yu send mi. And naw, Papa honor mi, make yu draw mi near yu, just as wi dey before di world start.
Jesus Pray For En Disciples
I don make di pipol wey yu give mi for dis world know yor name. Na yor own dem bi before yu give dem to mi and dem don obey yor word. Naw, dem don know sey evritin wey yu give mi kom from yu, bikos I don tell dem di message wey yu give mi. Dem don asept wetin I tell dem and dem know and bilive sey na yu send mi. I dey pray for di pipol wey yu give mi, bikos dem bi yor own, but I nor dey pray for di oda pipol wey dey inside di world. 10 Evritin wey I get, na yor own and evritin wey yu get, na my own and dem don honor mi. 11 I nor go dey di world again, but dem go still dey inside di world, since I won kom meet yu. Holy Papa, make yor name protet di pipol wey yu give mi, so dat dem go bi one, just as mi and yu na one. 12 Wen I dey with dem, I keep dem with yor name. No one lost, escept di one wey yor word sey e go perish.
13 Since I dey kom meet yu, I dey tok all dis tins for di world, so dat dia joy go full well-well. 14 I don give dem yor word and bikos of dat, di pipol for world hate dem, since dem nor bilong to di world, as misef nor bilong to di world. 15 I nor sey make yu remove dem from di world, but make yu protet dem from di devil. 16 Dem nor bilong to di world, just as misef nor bilong to di world. 17 Make yu protet dem with di trut, bikos na yor word bi di trut. 18 Just as yu send mi kom inside dis world, na so too I send dem go inside di world. 19 I don separate mysef from di world for dia sake, so dat dem go fit separate diasef from di world too.
Jesus Pray For Pipol Wey Go Bilive
20 I nor dey pray for dem alone, but I also dey pray for oda pipol wey go bilive mi thru di word wey dem go tok about mi. 21 Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi. 22 I don give dem di honor wey yu give mi, so dat dem go bi one just as wi bi one: 23 I dey with dem and yu dey with mi, so dat dem go really bi one, just as wi bi one and di world go know sey na yu send mi and yu love dem, as yu love mi.
24 Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
25 Holy Papa, even if di pipol for di world nor know yu, I know yu and dis ones know sey na yu send mi. 26 I don help dem know yor name and I go dey try to make oda pipol know am too, so dat di love wey yu get for mi, go dey with dem, as I dey with dem.”