19
Pilate Try To Free Jesus
Den Pilate kon sey make dem flog Jesus with koboko. Den di sojas go kut tree branches wey get shuku-shuku make crown put for en head and dem kon wear am klot wey dear well-well. Dem kon dey laf am, dey take am make yeye, dey sey, “Make una kon si di Jew pipol king.” Dem slap am for face many times.
Pilate kom out again kon tell di Jew oga dem sey, “I won bring am kom out for una, to let una know sey I nor si anytin bad wey e do.” So Jesus kom outside, with di shuku-shuku crown for en head and di fine klot wey dem gi-am wear. Den Pilate kon sey, “Na di man bi dis!”
Wen di priest oga dem and di temple polish dem si am, dem kon dey shaut, “Nail am for cross! Nail am for cross!”
Den Pilate sey, “Make only una go nail am. But as for mi, I nor si any bad tin wey e do.”
Di Jew oga dem ansa, “Wi get law and di law sey, e suppose to die, bikos e sey en na God Pikin.”
Wen Pilate hear wetin dem tok, fear kon katch am well-well. So e enter di house back kon ask Jesus, “Na where yu from kom sef?” But Jesus nor ansa am. 10 So Pilate kon sey, “Yu nor won tok to mi? Yu nor know sey I get pawa to free or kill yu?”
11 Jesus ansa, “Yu nor get pawa at-all for my life, escept God gi-am to yu. So, na di pipol wey bring mi kom meet yu, na dia sin big pass yor own.”
12 From dat time, Pilate kon bigin find way to free Jesus, but di Jew oga dem kon dey shaut, “If yu free dis man, yu nor bi Caesar friend. Anybody wey sey en bi king, na Caesar enemy e bi.”
13 Wen Pilate hear wetin dem tok, e bring Jesus kom out kon sidan for di chair for where e dey judge kase, (dem dey koll di chair, “Di Stone Pavement”, but na Gabbata dem dey koll am for Aramaik language.) 14 (Dat time na aftanoon for di day wen dem dey prepare for Passova Feast).
So, Pilate kon tell di Jew oga dem, “Make una look, na una king bi dis!”
15 Den, dem kon bigin dey shaut, “Kill-am trowey! Kill-am trowey! Make yu kill-am!”
Pilate kon ask dem, “Una wont make I nail una king for cross?”
Di High Priest dem kon sey, “Di only king wey wi get na Caesar.”
16 So Pilate kon gi-am to dem make dem go kill-am. Den dem kon take Jesus komot for der.
Jew Pipol Kill Jesus
17 As Jesus karry en cross dey go, e kon rish di place wey dem dey koll “Di Skull” (na Golgota dem dey koll di place for Aramaik language.) 18 For der, dem kon nail Jesus for cross. Dem still nail two oda pipol for cross, one for en rite and di oda for en left.
19 Pilate kon rite for sign-board wey dem nail on-top Jesus cross, wey sey, “dis na Jesus wey kom from Nazaret, wey bi di Jew pipol king.” 20 Since di place where dem kill Jesus near town, many of di Jew pipol wey dey for Jerusalem kom read di sign-board, bikos dem rite am for three language wey bi Aramaik, Latin and Greek. 21 Den di shief priests kon tell Pilate, “Make yu nor rite sey, dis na Jew pipol king, but rite sey, dis man sey, ‘I bi Jew pipol king.’ ”
22 But Pilate ansa dem, “Wetin I don rite finish, na so e go bi.” 23 Wen di sojas don nail Jesus for cross, dem tear en klot and dem for kon divide am. But dem leave di fine koat (bikos e nor get where dem join am, since dem weave-am from top go rish bottom).
24 So di sojas tell each oda sey, “Make wi nor tear am, but make wi gambol to si who go take am.”
Dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey,
“Dem go divide my klot,
afta dem don gambol for am.”
Dis na wetin di sojas kon do.
25 By dis time, di only pipol wey stand near di cross where dem nail Jesus, na-im mama; en aunty, Mary wey bi Klopas wife and Mary Magdalin. 26 So wen Jesus si en mama and John, di disciple wey e love well-well stand for der, e kon tell en mama, “Mama, look, dis na yor pikin.” 27 Den e tell di disciple, “Make yu look, dis na yor mama.” From dat time, di disciple kon take Jesus mama go en own house. 28 Wen Jesus si sey evritin don finish, e kon sey, “Wota dey hongry mi”, (dis show sey wetin God tok, really happen).
Jesus Die
29 Di sojas soak sponge inside wine wey betta, wey dey one kontaina for der kon put am for di branches of one plant wey dem dey koll hyssop kon stresh am put for Jesus mout. 30 Wen e don taste di wine, Jesus kon sey, “Evritin don finish.” Den e bend en head down, kon die.
31 Dis tin happen for di day wen dem dey prepare for di Passova Feast and bikos dem nor wont make di dead body dem stay for cross for Sabat Day, (bikos dat Sabat Day na special one for dem), di Jew oga dem kon tell Pilate make dem break dia leg, to make sure sey dem don die, so dat dem go fit bring dia dead body kom down. 32 So di sojas break di oda two pipol leg wey dem kill with Jesus. 33 But wen dem rish di cross wey Jesus dey and si sey e don die, dem nor kon break en leg. 34 But one soja kon take spear shuk di korna of en belle, den blood and wota kon dey rush kom out. 35 All dis story na true, (bikos na di pesin wey si dem happen, naim tok about dem and wetin e tok na true), so dat una go fit bilive. 36 All dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem nor go break one singol bone for en body.” 37 And God word still sey, “Dem go stand dey sopraiz as dem dey look di pesin wey dem shuk en body.”
38 Afta dis time, Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jesus sekret disciple, (bikos e dey fear di oda Jew oga dem), kon ask Pilate make e allow am karry Jesus dead body komot for der. Pilate gri for am and e go karry Jesus body komot.
Dem Beri Jesus
39 Nikodimos, di man wey hide go si Jesus for nite, kon follow Josef. E karry perfume wey heavy rish seventy-five pounds, wey dem take myrrh and aloe spice make. 40 Den dem pour di perfume for Jesus body kon wrap am with linen klot akordin to di way Jew pipol dey prepare dead body for beri. 41 One gardin dey near di place where dem kill Jesus and one new grave wey dem neva beri anybody put before, dey inside di gardin. 42 Since dat day na di day wey Jew pipol dey prepare for di Passova Feast and bikos di new grave dey near der, dem kon beri Jesus inside di grave.