20
Jesus Wake-up From Grave
For di first day for di week, wen day neva break well, Mary Magdalin kon go where di grave dey. E si sey dem don remove di stone wey dem take kover di grave mout. Den e run go meet Simon Pita and John kon tell dem, “Somebody don karry Jesus body komot from di grave and wi nor know where dem put am.”
So Pita and John kon go where di grave dey. Di two of dem kon dey run togeda, but John run pass Pita kon first am rish di grave. E nor enter inside di grave, but e bend down kon si di linen klot wey dem take wrap Jesus body for groun inside di grave. Wen Simon Pita rish der, e enter inside di grave kon si di linen klot for groun too. But di small klot wey dey for Jesus head nor dey for di same place where di oda klot dey, e dey on en own for one korna. Den John kon enter inside and wetin e si kon make am bilive. (Bikos dem undastand God word wey sey, Jesus go wake-up afta e die).
Jesus Show Ensef To Mary Magdalin
10 So di two disciple kon go back to dia house. 11 But Mary stand for outside di grave dey kry. As e still dey kry, e kon bend down look inside di grave. 12 Den e si two angel wey wear white klot sidan for where dem put Jesus body. One dey for where di head dey and di oda dey for where di leg dey.
13 Dem kon ask am, “Woman, why yu dey kry?”
Mary ansa, “Dem don karry my oga komot and I nor know where dem karry am go.” 14 Afta e tok finish, e turn round kon si Jesus stand for der, but e nor know sey na Jesus bi dat.
15 Jesus tell am, “Woman, why yu dey kry? Na who yu dey find?”
Bikos Mary tink sey naim bi di gardina, e kon sey, “Oga God, if na yu karry am komot, make yu tell mi where yu karry am go, so dat I go-go karry am.”
16 Den Jesus koll am, “Mary.”
So, Mary turn round face am kon koll am for Hibru language, “Raboni!” (wey mean Tisha).
17 Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”
18 Den Mary Magdalin go meet di disciples for where dem dey kon tell dem, “I don si di Oga God!” Den e tell dem wetin Jesus tell am.
Jesus Show Ensef To En Disciples
19 Dat evening, for di first day for di week, en disciples kon gada togeda. Dem lock di door for di house wey dem dey, bikos dem dey fear di Jew oga dem. Jesus stand among dem kon sey, “Make peace dey with una.” 20 Wen e don tok finish, e show dem en hand and di korna for en belle wey dem shuk with spear. Den di disciples kon happy well-well, wen dem si Jesus.
21 Den Jesus tell dem again, “Make peace dey with una. As my Papa send mi, na so I send una too.” 22 Wen e tok finish, e breath for dia body kon sey, “Make una receive di Holy Spirit. 23 If una forgive anybody en sin, God go forgi-am, but if una nor forgive anybody en sin, God nor go forgi-am.”
Jesus Show Ensef To Tomas
24 For dis time, Tomas (wey bi twins), one among di twelf disciples, nor dey der wen Jesus show ensef to dem. 25 Di oda disciples kon tell am, “Wi don si Jesus.”
But e ansa dem, “Unless I si en two hand wey dem nail kon put my finger inside di whole wey di nail make and shuk my hand inside di whole wey dey en belle, I nor go ever bilive una.”
26 Afta eight days, wen all di disciples gada again inside di house and Tomas dey der with dem dis time, even doh sey dem lock all di doors, Jesus show ensef kon stand among dem sey, “Make peace dey with una.” 27 Den e tell Tomas, “Put yor finger for my hand, make yu tosh am. Stresh yor hand put inside di korna for my belle. Make yu nor dey doubt again, but make yu bilive.”
28 Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”
29 Den Jesus tell am, “So yu bilive naw, bikos yu don si mi? God go bless pipol wey neva take eye si mi, but dem bilive mi.”
30 Jesus do many mirakles wen e dey with en disciples wey dem nor rite for dis book. 31 But dis tins wey dem rite so, na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am, una go get life thru en name.