6
Jesus Feed 5,000 Pipol
Wen Jesus don tok finish, e kon cross go Tiberias wey dey di oda side for Galilee wotaside. Plenty pipol follow am, bikos dem si wen e heal pipol wey nor well. Jesus komot for der go di mountin side kon sidan der with en disciples. (Dat time, Passova Feast don rish.)
Wen Jesus look up, e si plenty pipol dey kom meet am. Den e ask Filip, “Na where wi go fit si bread buy wey all dis pipol go chop?” Jesus tok dis one make e for si wetin Filip go do, bikos en ensef know wetin e won do.
Filip ansa, “Even if wi buy bread wey rish two hundred silva koins and if dem share am small-small, e nor go rish evribody chop.”
Anoda disciple wey en name bi Andru, wey bi Simon Pita broda kon tell Jesus sey, “One boy dey here wey get five bread and two fish, but dis one nor go rish dis plenty pipol chop at-all!”
10 Jesus ansa, “Tell all di pipol make dem sidan” (as plenty grass dey di place wey dem go fit sidan put). Di men wey sidan, rish 5,000. 11 Jesus take di bread kon tank God. Den e divide am give di pipol wey sidan. E do di same tin with di fish. All of dem chop as dem wont kon beleful well-well.
12 Wen evribody don beleful, Jesus kon tell en disciples, “Make una gada wetin remain, make anytin nor waste.” 13 Wen dem gada wetin dem chop remain for di five bread, e full twelf basket.
14 So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.” 15 Since Jesus know sey dem go won take am by force go make am dia king, only en kon komot go on-top di mountin alone.
Jesus Waka On-top Wota
16 Wen evening rish, en disciples kon go wotaside go wait am, 17 dem enter one kenu, cross go Kapanaum (by dis time, evriwhere don dey dark and Jesus neva kom meet dem.) 18 Den strong breeze bigin blow and di river kon dey rof well-well. 19 Wen dem don padol di kenu go rish about three or for mile, dem si Jesus dey waka on-top di wota dey kom near dem. Fear kon katch dem well-well. 20 Jesus tell dem, “Na mi, make una nor fear.” 21 As dem dey try make e enter inside di kenu, dem kon si sey di kenu don rish where dem dey go.
22 Wen day don break, di pipol wey dey di oda side for di river know sey na only one small kenu dey der. Dem still know sey Jesus enter di kenu with dem. 23 So some kenu wey kom from Tiberias kon rish di wotaside near di place wey dem for chop bread, afta Jesus don pray. 24 So wen di pipol si sey Jesus and en disciples nor dey der, dem enter di kenu kon go look for Jesus for anoda town wey dem dey koll Kapanaum.
25 Wen dem si Jesus for di oda side for di river, dem ask am, “Tisha, wish time yu kom here?”
26 Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, na bikos of di bread wey una chop naim make una dey find mi, nor bi bikos of di mirakles wey una si. 27 Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”
28 Dem kon ask am, “Wetin wi go do to make God happy with us?”
29 Jesus ansa, “God wont sey make una bilive di pesin wey E send.”
30 Dem still ask Jesus, “Wish kind mirakle yu go do make wi si, make wi for bilive yu? 31 Awa grand-grand papa dem chop manna for wildaness as dem rite for God word sey, ‘God give dem bread from heaven to chop.’ ”
32 Den Jesus tell dem, “Make I tell una true word, nor bi Moses give una bread from heaven, but God, wey bi my Papa, na-im give una di true bread from heaven. 33 God bread na di pesin wey kom down from heaven kon give betta life to di pipol wey dey dis world.”
34 So dem tell am, “Oga God, from naw go, make yu give us dis bread.”
35 Jesus kon tell dem, “Na mi bi di bread wey dey give life. Pesin wey kom meet mi nor go hongry lie-lie and di pesin wey bilive mi, nor go hongry for wota again. 36 As I don tell una, una dey si mi, but una nor bilive. 37 Anybody wey my Papa give mi, go kom meet mi and wen e kom, I nor go ever drive am. 38 Nor bi to do wetin I wont make mi kom down from heaven, but na to do wetin my Papa wont. 39 Wetin my Papa wey send mi wont, na make I nor luz anybody wey e give mi, but make I for take dem go up for di last day. 40 Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”
41 Den di Jew pipol bigin vex and komplain about Jesus, bikos e tok sey, “Na mi bi di bread wey kom down from heaven.” 42 Den dem sey, “Dis Jesus sef nor bi Josef pikin, wey wi know en papa and mama? Na how e kon dey tok sey, ‘I kom down from heaven?’ ”
43 Jesus ansa, “Make una nor komplain about mi give each oda. 44 Nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa wey send mi draw am kom meet mi and I go take am go up for di last day. 45 Na so di profets rite sey, ‘God go tish evribody.’ Anybody wey hear wetin my Papa tok, go kom meet mi. 46 (Nor bi sey anybody don si di Papa before, escept mi wey kom from heaven). 47 I dey tell una true word, anybody wey bilive mi, don get life wey nor dey end. 48 Na mi bi di bread wey dey give pesin life. 49 Una grand-grand papa dem chop manna for wildaness, but dem still die. 50 Dis na di bread wey kom from heaven, so dat anybody wey chop am, go get life wey nor dey end. 51 Na mi bi di bread wey kom down from heaven. Anybody wey chop dis bread go live forever. Na my flesh bi di bread wey I go give di pipol wey dey for dis world.”
52 Den di Jew pipol wey dey vex with Jesus kon bigin dey argue with one anoda dey sey, “How dis man go give us en flesh make wi chop?”
53 Jesus tell dem, “I dey tell una true word, unless una chop Man Pikin flesh and drink en blood, una nor go get life for inside una. 54 Di pesin wey go chop my flesh and drink my blood, don get life wey nor dey end and I go take am up for di last day. 55 My flesh na di real food and my blood na di korrect drink. 56 Di pesin wey chop my flesh and drink my blood, go stay inside mi and I go dey inside am too. 57 Na my Papa wey dey for heaven send mi and as I dey for dis life bikos of am, na so di pesin wey chop my flesh go get life, bikos of mi. 58 Dis na di bread wey kom down from heaven, e nor bi like di bread wey una grand-grand papa dem chop and afta, dem still die. Di pesin wey go chop dis bread nor go ever die, but e go live forever.”
Many Pipol Follow Jesus
59 Jesus tok dis tins wen e dey tish dem for inside di temple for Kapanaum. 60 Wen Jesus many disciples hear wetin e tok, dem kon sey, “Dis tin wey Jesus dey tok so hard well-well o-o! Na who go fit undastand dem?”
61 Wen Jesus know sey en disciples dey komplain about wetin e tok, e kon ask dem, “Wetin I tok so dey make una vex too? 62 Wetin go happen if una si Man Pikin go back to heaven where e dey before? 63 Na di Spirit go fit give pesin life; human being pawa nor fit do am. All dis word wey I dey tell una so, dem bi Spirit and dem dey give pesin life. 64 But some of una nor bilive.” (From biginnin, Jesus don know di pipol wey nor go bilive and di pesin wey go sell am give en enemy.) 65 So Jesus kon sey, “Na bikos of dis I tell una sey, nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa let am kom.”
Pita Tok About Jesus
66 Afta dis, Jesus many disciples kon stop to follow am.
67 Den Jesus ask en twelf disciples, “Una won go too?”
68 Den Simon Pita ansa am, “Oga God, na who wi go kon go meet? Na yu get di word wey dey give pipol di life wey nor dey end. 69 Wi don bilive and know sey, ‘Na yu bi di Holy One wey God send kom meet us.’ ”
70 Jesus ansa, “Nor bi twelf of una I choose? But one pesin among una na devil pikin.” 71 (E tok dis one about Judas, wey bi Simon Iskariot pikin, bikos na dis Judas, wey bi one among en twelf disciples, naim go sell am give en enemy.)