7
Tabanako Feast
Afta, Jesus kon travel go evriwhere for Galilee. Den e komot for Judea, bikos di Jew oga dem won kill-am. Di time kon rish wen Jew pipol dey do dia feast wey dem dey koll Tabanako Feast. Jesus brodas kon dey tell am, “Komot for here go Judea, make yor disciples si di mirakles wey yu dey do. Bikos anybody wey wont make pipol sabi who e bi, nor go do anytin for korna. Since yu dey do dis tins, e good sey make yu show yorsef to evribody.” (Even en brodas nor bilive wetin Jesus dey do.)
Jesus ansa dem, “Time neva rish for mi to go, but una fit go anytime una like. Pipol like una, but dem nor like mi, bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good. Make una go di feast, I nor go-go, bikos my time neva rish.” Afta e don tok finish, e kon stay for Galilee.
10 But wen en brodas don go di feast, Jesus kon go der too, but e nor let anybody know sey e dey der. 11 Di Jew oga dem kon dey ask pipol, “Where e dey?”
12 Dem kon dey tok among demsef. Some sey, “Jesus na good pesin”, but odas sey, “E dey play pipol wayo.” 13 But nobody fit tok out, bikos dem dey fear di Jew oga dem.
Jesus Tish For Di Temple
14 Wen di feast don rish half, Jesus enter di temple kon dey tish. 15 Di Jew oga dem sopraiz and dem kon dey sey, “How e take know dis tins wey e dey tish so, as e bi sey e nor go skool at-all?”
16 Jesus ansa dem, “Wetin I dey tish nor bi my own, but na di Pesin wey send mi, na-im give mi. 17 Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own. 18 Anybody wey dey tok with en own pawa, go wont make pipol praiz am, but di pesin wey won honor who send am, naim dey do wetin korrect and sin nor dey inside am. 19 Moses nor give una di law? But una nor gri obey am. Why e bi sey una won kill misef?”
20 Di pipol ansa Jesus, “Demon don enter yor body! Who won kill yu?”
21 Den Jesus ansa, “Na one mirakle wey I do so, make una dey sopraiz? 22 Na true sey Moses tell una to sekonsaiz una son, (nor bi Moses start am, na from Abraham time e start) and una dey sekonsaiz una son for Sabat Day. 23 Since una dey sekonsaiz for Sabat Day so dat una nor go break Moses Law, why una dey vex with mi, bikos I heal dis sick man for Sabat Day? 24 Make una nor dey judge pesin, bikos of wetin una si with una eye, but make una give korrect judgement as e suppose to bi.”
Who Jesus Bi
25 Some pipol wey dey stay for Jerusalem kon dey sey, “Dis nor bi di man wey dem won kill? 26 Naim dey here dey tok for publik so and dem nor fit tell am anytin. Abi di oga dem don gri sey naim bi di Christ? 27 Wisef know di place where dis man from kom and wi know sey anytime wey Christ go kom, nobody go fit know where e go kom from.”
28 As Jesus dey tish for di temple, e kon shaut sey, “Una know mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I take kom, na God wey send mi naim bi di korrect Pesin. But una nor know am. 29 But I know am well-well, bikos na from am, I kom and naim send mi.”
30 Dem kon try to katch Jesus, but nobody fit tosh am, bikos en time neva rish. 31 Many pipol for der bilive am kon sey, “Anytime di pesin wey bi di Christ kom, e go fit do mirakle wey pass wetin dis one dey do so?”
32 Wen di Farisee pipol hear pipol dey tok about Jesus, dia oga and di priests kon send sojas go arrest am.
33 Jesus kon tell dem, “I go only stay with una for small time and afta, I go-go meet di Pesin wey send mi. 34 Una go dey look for mi, but una nor go si mi and una nor go fit kom meet mi for where I dey.”
35 Den di Jew oga dem kon dey ask each oda, “Where e won go wey wi nor go fit si am, abi e won go tish Jew pipol wey dey stay with Greek pipol? 36 Wetin e mean wen e tok sey, ‘Una go look for mi, but una nor go si mi and where I dey, una nor go fit kom der?’ ”
Wetin Jesus Tish About Di Spirit
37 For di last day for di feast, wey bi di biggest day, Jesus stand kon shaut, “If wota dey hongry anybody, make e kom meet mi. 38 Di pesin wey bilive mi and wetin I tok, make e kom drink, just as God word sey, ‘Plenty wota wey dey give life, go flow from inside en belle.’ ” 39 (E tok dis tin about di Spirit wey di pipol wey bilive am go get, bikos by dis time, God neva give en Spirit to pipol, bikos E neva honor Jesus Christ.)
Wetin Pipol Tok About Jesus
40 Wen pipol hear wetin e tok, some for dem kon sey, “True-true, dis man naim bi di Profet!”
41 Some still sey, “Na-im bi di Christ”, but odas sey, “Na lie, Christ nor fit kom from Galilee. 42 Abi God word nor sey, ‘Christ go kom from David family wey dey Betlehem, di village wey David from kom?’ ” 43 So di pipol kon divide bikos of Jesus. 44 Some of dem kon dey try to katch am, but nobody fit take hand tosh am.
Pipol Nor Agri Bilive Jesus
45 Wen di sojas go back, di priest oga dem and Farisee pipol kon ask dem, “Why una nor katch Jesus kom?”
46 Di sojas ansa, “Wi neva si anybody wey tok like dis man before!”
47 Den di Farisee pipol kon ask di sojas, “Abi, e don deceive una too? 48 Abi any of us wey bi Farisee pipol or priests don bilive Jesus? 49 Curse dey dis pipol head, bikos dem nor know di law.”
50 Den one man wey en name bi Nikodimos, wey don first go meet Jesus and wey bi one of di big oga dem kon sey, 51 “Awa law nor dey kondemn pesin unless wi don hear wetin di pesin tok or si wetin e dey do, abi nor bi so?”
52 Dem kon ask am, “Abi na Galilee yu too from kom? If yu look well, yu go si sey know profet go fit kom from Galilee.”
53 Afta dis, evribody bigin go en house.