20
Dem Arrest Jeremaya
Wen Imma pikin Pashhur wey bi di priest and wey dey guide di temple e kon oda sey make dem beat and tie mi with shain, den put mi for one room near Benjamin Gate for di temple. But di next day, afta Pashhur don release mi, I kon tell am, “God nor koll yu Pashhur, but di name wey E give yu na, ‘Fear Dey Evriwhere.’ God sey, ‘I go make yu dey fear yorsef and yor friends go dey fear yu too. Yu go dey si as dia enemies go kill dem finish. I go make Judah pipol serve Babilon king and e go take some of dem go en kountry as slave kon kill di odas. I go still make dia enemies tif dia propaty kon seize all di betta-betta tins. Dem go karry Judah king propaty go Babilon. Pashhur! Dem go karry yu with yor family go Babilon. Yu go die and yu with all yor friends wey yu lie give, dem go beri una for der.’ ”
Jeremaya Komplain Give God
My God, Yu don deceive mi!
Yu don deceive mi so dat I go bi yor profet?
Yu strong pass mi and Yu get pawa well-well.
Naw, evribody dey look and laf mi.
Na only bad-bad tins and deat
I dey profesy about.
Na only curse and trobol
yor message don bring kom meet mi.
But wen I sey, “I go forget God
and I nor go tok with en name again,”
na dat time yor message dey bi like fire
wey dey burn inside my body.
Even wen I try to pritend sey nor-tin dey happen,
I nor dey fit.
10 I hear as pipol dey gossip mi.
Dem dey koll mi,
“Di Man Wey Fear One Kill.”
Dem dey treaten sey,
“If yu tok anytin here,
wi go ripot yu.”
Even my friends before,
dey look and dey wait make I fall.
Dem dey sey, “E go fall enter di trap,
den wi go know sey wi don revensh am back.”
11 But God wey strong and get pawa,
dey my side.
So doz wey dey plan against mi, go fail.
Yu go disgrace dem forever,
bikos dem nor go susid
and dem nor go ever forget di disgrace.
12 My God wey dey mighty;
Yu dey give korrect judgement to pipol
and Yu know wetin dey dia heart and mind.
So, make I si how Yu won take revensh my enemies,
bikos I don put my problem for yor hand.
13 Make wi sing to God! Make wi praiz God,
bikos E save doz wey wiked pipol dey opress.
14 I curse di day wey dem born mi!
Make dem forget di day wey my mama born mi!
15 Make curse follow di pesin wey kon make my papa happy
wen e tell am sey,
“Na boy yor wife born.”
16 Make di pesin bi like town wey God nor sorry for
wen E dey distroy tins.
Make e hear pipol dey kry with pain for morning
and na war kry go full en ear for aftanoon.
17 Bikos if to sey e kill mi before dem born mi,
my mama belle for bi my grave and I for dey der forever.
18 Why dem born misef?
Na make I for si trobol and always dey kry,
so dat my life go end with shame.