21
God Give Jerusalem To En Enemies
King Zedekaya send Pashhur wey Malkijah born and Zefanaya, di priest wey bi Maaseaya pikin, go meet Jeremaya, but God don tell Jeremaya before dem rish der. Zedekaya sey make dem tell Jeremaya sey, Make yu help us beg God, so dat E go kom save us, bikos King Nebukadnezzar for Babilon dey kom attack us. May bi God go do en mirakle, just as E do before kon stop King Nebukadnezzar, so dat e nor go kom attack us again. Jeremaya ansa dem, “Make una go tell King Zedekaya sey Israel God sey, ‘I go distroy yor sojas wey dey fight against Babilon king and en sojas. I go bring dia sojas kom di town centre. Na with all my pawa, vexnashon and fire, I go take fight against yu. I go kill evribody for dis land. Na bad diziz I go take kill both di pipol and dia animals. Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”
God still sey make I tell di pipol, “Make una listin! Mi wey bi God, dey give una shance to choose between dis two tins: ‘Di way wey dey lead to life or di one wey dey lead to deat.’ War or honga go kill anybody wey dey di town, but doz wey go kom out kon surenda give Babilon king, nor go die; dem go eskape with dia life. 10 Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun.
Mi, wey bi God, don tok.”
Judgement For Di Royal House For Judah
11 God sey make I tell David shidren-shidren wey dey di royal house for Judah sey,
12 “Make una listin to wetin mi wey bi God dey tok.
Make una make sure sey
dem dey always give korrect judgement for kourt.
Make una protet pesin wey dem dey opress
from who dey opress am
and bikos of di bad tins wey una dey do,
my vexnashon go burn una like fire wey nor dey kwensh.
13 Jerusalem wey dey on-top di valley like rock
wey high well-well,
make yu listin to mi.
I go fight against yu, bikos yu sey,
‘Nobody go fit attack or skata awa town.’
14 But I go ponish yu for wetin yu don do.
I go lite fire put for yor palis
and di fire go burn evritin finish.
Mi, wey bi God, don tok.”