25
Enemies For Nort
For di fourt year wey Jehoiakim, Josaya pikin bi king for Judah, God tok to Jeremaya about all di pipol for Judah. (Dis na di first year wey Nebukadnezzar dey rule for Babilon.) So I tell Judah and Jerusalem pipol: “For twenty-three years, from di thirtint year wey Amon pikin, Josaya bi king for Judah kon rish naw, na-im God don dey tok to mi and I nor dey fail to tell una wetin E tok, but una nor gri listin. Una nor go listin or hear, even doh God dey always send en savants kom meet una. Dem tell una make una shange di kind life wey una dey live kon stop all di wiked tins wey una dey do, so dat una go kontinue to dey stay for dis land wey God give una and una grand-grand papa. Dem sey make una nor woship or serve oda gods and make una nor make God vex bikos una dey woship juju. So, if una obey God, E nor go ponish una. But God sey una nor gri listin to am. Instead, una dey make am vex with doz una juju kon bring ponishment for una head.
“So, bikos una nor gri listin to am, God wey dey mighty sey, ‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem. 10 I nor go make una happy or do marriage again. Una nor go si oil pour for una lamp and korn nor go dey for una to chop. 11 Dis land go empty, So Israel pipol and doz wey dey stay near dem, go serve Babilon king for seventy years.’
12 “ ‘But wen di seventy years don finish, I go ponish Babilon and en king for dia sin. I go distroy and skata dat kountry forever. 13 I go make evritin wey I tok happen for dat land; evritin wey dem rite for dis book wey Jeremaya profesai against dis nashon, must happen. 14 I go pay Babilon pipol back for wetin dem do and dem go bi slave to many nashon and great kings.’ ”
God Judge Di Nashon
15 Oga wey bi Israel God tell mi, “Make yu take dis wine cup wey my vexnashon full and make all di nashons wey I send yu go meet, drink from am. 16 Wen dem drink am finish, dem go stagga kon dey bihave anyhow, bikos I dey send war kom meet dem.”
17 So I take di cup from God hand kon go di nashons wey God send mi go and I make all of dem drink from am. 18 I go make Jerusalem and all di towns for Judah, dia kings and all dia ofisas drink from am, so dat di land go turn to desert, where dem dey trow dirty put and wen pipol si am, dem go shok with fear. Den pipol go use dia name dey curse pipol, just as dem don already dey use am. 19 Dis na di oda pipol wey drink from di cup: King Fero for Egypt; doz wey dey serve am; en ofisas, en pipol; 20 di strenjas for Egypt; di kings for Uz land; di kings for Filistia land, Ashkelon, Gaza, Ekron pipol and di pipol wey dem nor kill for Ashdod town; 21 Edom, Moab and Ammon pipol; 22 di kings for Tyre, Sidon and di lands near di sea; 23 Dedan, Tema, Buz and all di pipol for desert wey kut dia hair short as dem dey di temple; 24 di kings for Arabia wey dey stay desert; 25 Zimri, Elam and Media kings; 26 di kings for nort both far and near and all di kingdoms wey dey dis eart. Afta all of dem don drink from God vexnashon cup finish, Babilon king must drink from am too.
27 Den God tell mi, “Tell di pipol sey mi, Israel God wey dey mighty, dey kommand dem make dem drink till di drink katch dem. Dem go dey vomit until dem fall for groun and dem nor go fit get up again, bikos I dey send war kom meet dem. 28 And if dem nor gri take di cup from yor hand kon drink from am, den tell dem: ‘God wey dey mighty sey una go must still drink from am.’ 29 Bikos na from my own town I go for start to distroy kom rish dia own. Dem tink sey dem nor go ponish dem? No! Dem go ponish dem, bikos I go send war kom meet evribody for di eart.
Mi, wey bi God wey dey mighty, don tok.”
30 “So, Jeremaya, make yu tell dem evritin wey I tok.
Yu must tell dem sey,
‘Like lion wey won attack,
na so too God go shaut from heaven!
E go shaut for en pipol
from en holy place.
E go shaut like pesin wey dey mash grape
wey dem won take do wine
and evribody for di world go hear am.’
31 Di nois go loud rish evriwhere for di eart.
Bikos God get wetin E one tok against di nashon.
E go judge evribody kon kill wiked pipol.
Mi, wey bi God, don tok.”
32 God wey dey mighty sey,
“Wahala go kom meet di nashon one-by-one
and strong breeze go gada
for where di world for end.
33 For dat day, di pipol wey God kill,
dia body go skata for difren part for di world.
Nobody go mourn for dem
and nobody go karry dem go beri.
Dem go dey groun
like manure wey dem gada.
34 Una wey bi leaders and my pipol shepad,
make una shaut kry well-well!
Make una mourn and roll for san-san,
bikos di time don rish
wen dem go kill una kon kut una like goat
35 and una nor go fit eskape.
36 Una dey kry with pain,
bikos God don use en vexnashon
distroy una nashon
37 kon skata una kountry
wey bin get peace.
38 God don forget en pipol
like lion wey waka
komot for en kage go find food.
Dia kountry don turn desert,
bikos dem dey fear pipol
wey dey opress dem
and dem dey fear God vexnashon too.”