26
Jeremaya For Kourt
As Josaya pikin, Jehoiakim just start to rule for Judah, God kon tell Jeremaya sey, “Go di temple go tell all di pipol from Judah wey dey kom woship for der, evritin wey I kommand yu. Make sure sey yu nor forget anytin wey I tell yu. May bi dem go listin kon stop to do di wiked tins wey dem dey do. If dem stop, I go shange my mind and I nor go distroy dem again. Tell dem sey di Oga wey bi God sey, ‘Una must obey mi and do wetin I tish una. My savants wey I send kom meet una, make una dey listin to evritin wey dem tell una. I dey always send dem kom meet una, but una nor gri listin to dem. If una nor gri obey mi, den I go distroy dis temple, just as I distroy Shiloh. I go make sure sey evribody for dis eart dey curse dis town.’ ”
As I dey tok for God temple, di priests, profets and di pipol, dey hear mi. So, as I just tok finish, dem kon seize mi dey shaut, “Wi suppose kill yu, bikos of dis rubbish wey yu dey tok so! Wetin make yu dey tok all dis foolish tins with God name? Wetin make yu dey tok with en name sey, ‘Dem go distroy dis temple, just as dem distroy Shiloh and nobody go dey here again.’ ” Den all di pipol kon gada round mi.
10 Wen di leaders hear wetin happen, dem rush kom di temple from di royal palis. Dem kon form one kourt for where di New Gate for God temple dey. 11 Den di priests and di profets kon tell di leaders and di pipol sey, “Make dem kill dis man, bikos e don tok against awa town. All of una hear as e dey tok.”
12 Den I sey, “Na God send mi kom tell una evritin wey I tok about dis temple and dis town. 13 Una must shange kon obey di Oga una God. Una must stop to live di bad life and wiked tins wey una dey do. If una stop am, God go shange en mind and E nor go distroy una. 14 As for mi, I dey una hand, so una fit take mi do anytin wey una like. 15 But make una know sey, if una kill mi, una and di pipol for dis town nor go get rest, bikos una don kill innocent pesin wey God send kom warn una.”
16 Den di leaders and di pipol kon tell di priests and di profet sey, “Na God name dis man take tok to us, so make wi nor kill-am.” 17 Afta, some of di leaders stand kon tell di pipol, 18 “Wen Hezekaya bi king for Judah, Profet Mikah from Moreshet profesai give di pipol. E tell dem sey, ‘God sey,
“ ‘ “Dem go klear Zion like field;
Jerusalem go turn where dem dey trowey dirty put
and di temple hill go turn forest.” ’
19 “King Hezekaya and di pipol nor kill Mikaya, abi dem kill-am? But King Hezekaya honor God kon try to win en favor. So, God kon shange en mind and E nor distroy dem again. But as e bi so, wi dey won kause sirious wahala for awasef.”
20 (Naw, e get anoda man wey profesai with God name against di pipol and di town, just as Jeremaya dey profesai. En name na Uriaya wey Shemaya born and e kom from Kiriat-Jearim. 21 And wen King Jehoiakim, en sojas and ofisas hear wetin Uriaya tok, e kon try to kill-am, but Uriaya hear kon run go hide for Egypt, bikos e dey fear. 22 Den King Jehoiakim send Akbor pikin Elnatan and some oda men go Egypt go katch Uriaya kom. 23 Dem bring am kon give King Jehoiakim wey kill and beri am for where dem dey beri ordinary pipol put.)
24 So dat day, Ahikam wey bi Shafan pikin, support and help mi, so dat di pipol nor go kill mi.