42
Di Pipol Say Make Jeremaya Pray For Dem
Den all di sojas oga with Johanan wey bi Kareah pikin and Jezanaya wey Hoshaaya born kom with oda pipol kon tell mi: “Abeg, make yu do wetin wi won tell yu so! Make yu help us wey dey alive pray to di Oga awa God. Wi many before, but naw, yusef dey si sey wi nor many again. Make yu pray make di Oga awa God show us where wi go-go and wetin wi go do.” So, I ansa, “No wahala! I go pray to di Oga awa God just as una tok, den I go tell una anytin wey E tok! I nor go hide anytin from una!” Den dem tell mi, “Make God wey dey tok true and dey faithful, bi awa witness if wi nor do wetin E sey make yu tell us. Weda wi like wetin God tok or not, wi go obey di Oga awa God wey wi sey make yu help us pray to. Bikos wi know sey, if wi obey am, evritin go dey well for us.”
God Ansa Jeremaya Prayer
Afta ten days, God tok to mi, so I kon koll Johanan, di sojas offisa, doz wey dey with am and di oda pipol. I tell dem, “Di Oga wey bi Israel God wey una sey make I pray give, dis na wetin E tok: 10 ‘If una ready to stay for dis land, I go build una up and una nor go skata again; I go plant una and nor-tin go fit rut una again. Na pains and sorrow full my heart, bikos of di wahala wey I kause for una. 11 Make una nor fear Babilon king; I dey with una and I go save una from en pawa. 12 I go show una mesi. So, I go make am sorry for una kon allow una go back to una own land.
Mi, wey bi God, don tok.’
13 “But if una sey, ‘Wi nor won stay for dis land!’ Den una dey disobey di Oga una God. 14 Make una nor sey, ‘No! E betta make wi go Egypt instead of us to stay dis land, bikos for der, wi go dey free from war and food plenty for der wey wi go chop.’ 15 If una wey remain for Judah do like dat, den make una hear wetin Israel God dey tok, ‘If una don gri sey una won go stay for Egypt, 16 den di war wey una dey fear, go happen and honga go kill una for der. 17 Na war, honga and diziz go kill all di pipol wey gri sey dem won go stay Egypt. No one among dem go survive or eskape di wahala wey I go bring for dem.’ 18 Bikos Israel God sey, ‘Just as I pour my vexnashon and fire for Jerusalem pipol, na so too, I go pour my vexnashon for una head, if una go Egypt. Pipol go si una dey fear, dem go hate and use una name as curse. Una nor go ever si dis place again.’
19 “I still tell dem, ‘God don tell una wey remain for Judah sey make una nor go Egypt.’ So I dey warn una, 20 make una nor make big mistake. Na una sey make I pray give di Oga awa God and una promise sey una go do evritin wey E kommand. 21 And naw, I don tell una, but una nor one gri do evritin wey God sey make I tell una. 22 So make una remember sey; una go die for war and honga and diziz go kill una for di land wey una dey run go stay.”